Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Numbers 10

1 God tell Moses say,

2 “Make two trumpet with hammered silver to dey use call the people together and to dey use break camp.

3 When dem blow the two trumpets for long, the community go gather round you for entrance of my Tabernacle Tent.

4 But when dem blow only one trumpet, make only the leaders of tribes come gather round you.

5 When dem blow the trumpet short, the tribes wey dey for east go move out.

6 When dem blow the trumpet short second time, the tribes wey dey for south go move out. So short blast na the sound dem go dey use break camp,

7 but dem go first blow the trumpet for long, so that dem go call the community together.

8 Na Aaron son go dey blow the trumpet. Na the rules wey una go dey follow for all time to come follow so.

9 If una dey fight enemy for una land, make una blow the trumpets loud, before una go fight them. The Lord una God go hear una, and he go save una from una enemies.

10 Make una dey also blow these trumpets for una special meetings, New Moon celebration, and una happy times together. Make una dey blow the trumpet when una dey give una burnt offerings and fellowship offerings. Na this go be special way for una God to remember una. Na me command una to do am; I be the Lord una God.”

11 On 20th day of second month for the second year after the people don leave Egypt, the cloud wey dey on top Tabernacle Tent rise,

12 and Israelites begin their journey out of Sinai Desert. The cloud come rest for Paran desert.

13 Dem begin dey march as God don command them through Moses,

14 and each time dem move, dem dey for same order. The people wey dey under banner of division wey tribe of Judah dey lead, na dem dey move first, family by family, and Nahshon be their commander.

15 Na Nethanel son of Zuar be commander of Issachar tribe,

16 and na Eliab son of Helon dey command tribe of Zebulun.

17 Naso dem take the Tent down, and tribe of Gershon and Merari, wey carry am, begin dey go.

18 The people wey dey under the banner of division wey tribe of Reuben lead, go begin dey go, family by family, and na Elizur son of Shedeur be their commander.

19 Na Shelumiel son of Zurishaddai dey command the tribe of Simeon,

20 and Eliasaph son of Deuel dey command tribe of Gad.

21 Then Levite tribe of Kohath go carry their objects and start to dey go. By the time dem reach next camp, dem go don set up the Tent again.

22 Those wey dey under banner of division wey tribe of Ephraim lead, go begin dey go, family by family, and na Elishama son of Ammihud be their commander.

23 Na Gamaliel son of Zurishaddai dey command the tribe of Manasseh,

24 and Abidan son of Gideoni dey command tribe of Benjamin.

25 Finally, those wey dey under banner of division wey tribe of Dan lead, dem go serve as guard wey dey for back of others, go begin dey go, family by family, and na Ahiezer son of Ammishaddai be their commander.

26 Na Pagiel son of Ochran dey command the tribe of Asher,

27 and Ahira son of Enan dey command tribe of Naphtali.

28 Na the order wey dem take march be this, family by family, whether the Israelites break camp or dem dey go.

29 Moses tell him brother-in-law, Hobab son of Jethro the Midianite say, “We go soon begin dey go the place wey God talk say he go give us. He don promise to make Israel prosper, so come with us, and we go share our prosperity with you.”

30 Hobab answer say, “No, I dey go back to my native land.”

31 Moses say, “Abeg no leave us. You know where we fit camp inside desert, and you fit be our guide.

32 If you come with us, we go share all the blessings wey God go give us with you.

33 When the people leave Sinai, the holy mountain, dem travel for three days. God Covenant Box dey always go ahead of them to go find a place for them to camp.

34 As dem dey move on from each camp, the cloud of God dey over them for day.

35 Anytime the Covenant Box begin dey go, Moses go say. “Arise, God; scatter your enemies and fight people wey hate you!

36 And when dem stop, he go say, “Return, God, to thousands of Israel families.”

Open Bible reader