Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Nahum 2

1 Nineveh, una dey under attack! The power wey go destroy una don come. Prepare una defence! Guard una road! And make una prepare for battle!

2 God don ready to bring back glory of Israel as e dey before their enemy come rob am.

3 The enemy soldier dey carry red sheild and dey wear red uniforms. Dem dey prepare to attack! Their chariot dey shine like fire! And their horse dey move fast!

4 The chariots dey run for the streets and dey rush to and fro for the city squares. Dem dey flash like touchlight, and dey flash from one place to another like lightening!

5 The enemy call for him best soldiers, dem fall as dem go front. Dem run to wall and set up their shield for batering ram.

6 The gate wey dey the river open and terror full the palace.

7 The enemy carry the queen commot, and her slaves cry loud like doves, and dem begin dey beat their breast to show say dem no dey happy.

8 Nineveh be like pool wey the water dey dry. People dey shout, “Stop! Stop to dey run away, but e no do am any good.

9 Carry Silver! Carry gold! Plenty things dey wey una fit carry. Treasure plenty for the city!

10 Now, Nineveh don empty. Dem don thief everything. The city don spoil. People don lose their courage, fear don melt their heart, their knees dey shake together, their body dey shake, and their face dey red.

11 Where the city wey be like lions house, the place where young lion dey chop, where the lions and lioness fit go and their pikin go dey safe?

12 The lion dey catch food and tear am to pieces for other lion and hin pikin; he fill him cage with animals wey him don kill and with the meat wey him don gather.

13 Almighty God talk say, “I be una enemy, Nineveh. “I go burn una chariots and kill una soldiers for battle, and I go take away everything una don take from others. Una no go kill anyone for earth again. I no go hear the demand of una messengers again.”

Open Bible reader