Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 28

1 Wen day break for Sabat Day, wey bi di first day for di wik, Mary Magdalene and di oda Mary kon go luk di grave.

2 At wons, strong eart-quake kom hapun, bikos God angel kom dan from hevun, rol di stone komot, kon sidan on-top am.

3 En face bi laik thunda lite and en klot white laik snow.

4 Di gaids kon dey shake and dem kon bi laik pipol wey won die, bikos fear kash dem wel-wel

5 Bot di angel kon tel di wimen, "Mak una nor fear, I no sey una dey luk for Jisos Kraist, wey dem nail for kros.

6 “E nor dey here, bikos God don wak-am up, jos as God promis. Mak una kom si di place wer e laidan bifor.

7 “Den mak una kwik go tel en disaipols sey, 'God don raiz-am from deat and e dey go wait for una for Galili. Una go si-am for der.' Mak una rimemba sey I tel una so! “

8 So fear mak dem run komot for di grave and dem kon dey hapi go tel en disaipols.

9 Bot Jisos Kraist mit dem for road kon tel dem, "I grit una o-o! “Dem kon dress near am, hol en leg kon woship am.

10 Den Jisos Kraist tel dem, "Mak una nor fear, bot tel my brodas mak dem go Galili and dem go si mi for der".

11 As dem dey go, som of di gaids go insaid di tawn go tel di prist oga dem evritin wey hapun.

12 Afta dem don gada and plan wit di eldas, dem kon giv di sojas plenti moni,

13 kon tel dem, "Mak una tok sey, 'Jisos Kraist disaipols kom tif en bodi for nite wen wi dey slip.'

14 If di govnor hear abaut dis mata, wi no wetin to tel am and una nor go enta trobol. “

15 So dem tak di moni and dem du as di eldas tel dem. Pipol stil dey tok dis stori for evriwer wey Ju pipol dey, kom rish today.

16 So di ilevun disaipols kon go Galili for di mountin wey Jisos Kraist tel dem.

17 Wen dem si-am, dem woship am, bot som of dem kon dey doubt.

18 Den Jisos Kraist waka near kon tel dem, "God don giv mi all di pawa wey dey hevun and eart.

19 “So mak una go mak pipol my disaipols for di hol wold, dey baptaiz dem wit di Papa, di Pikin and di Holi Spirit name,

20 dey tish dem to du evritin wey I tish una. I go always dey wit una ontil di wold go end."

Open Bible reader