Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 24

1 As Jisos dey komot from di Tempol, en disaipols kon show am haw di Tempol buildin bi.

2 Jisos kon tel dem, "Una dey si all dis tins? I tel una tru wod, wen di taim rish, won blok nor go dey on-top anoda won, bikos di buildin go skata finish! “

3 As Jisos sidan for Mount Olives, en disaipols kom mit am for kona ask am, "Mak yu tel us wen dis tins go hapun? Haw wi go tak no sey di taim wen yu go kom, don rish? “

4 Jisos ansa dem, "Mak una shine una eye, so dat nobodi go fit disiv una.

5 “Meni pipol go kom wit my name dey sey, 'I bi Kraist wey bi di Mesaya' and dem go disiv meni pipol.

6 “Una go dey hear rumor sey war dey hapun for difren place. Mak una nor fear, bikos e must hapun, bot di taim wey I go kom, neva rish.

7 “Won kontri go fite wit anoda kontri and won kindom go fite wit anoda kindom. Hunga go dey evriwer and eart-quake go hapun for difren place.

8 “Wen dis tins go dey hapun, e go bi laik wen bele dey pain wuman wey won born. “

9 “Dem go kari una wey bi my disaipols giv pipol wey go sofa and kil una. Bikos of mi, pipol for difren tawn wey nor no God, go hate una.

10 “Meni pipol nor go gri folo mi again and dem go dey lai and hate ish oda.

11 “Meni wayo profets go kom and dem go disiv meni pipol.

12 “Bikos pipol nor go obey God law, di luv wey meni pipol get for God, nor go strong again.

13 “Bot God go save di pesin wey go bear go rish end.

14 “Bifor di wold go end, my pipol go prish abaut God Kindom go rish evriwer. “

15 “As Profet Daniel tok, 'Bad tins go hapun for di holi place, insaid di Tempol' (Enibodi wey hear dis wod, mak e undastand wetin e min).

16 “Pipol for Judea go run go on-top mountin.

17 “Pesin wey dey on-top roof, mak e nor kom dan kon tak enitin from en haus

18 and pesin wey dey farm, mak e nor go bak to en haus go tak en klot.

19 “For dis taim, e go hard wel-wel for wimen wey get bele and doz wey get smol pikin for hand.

20 “Mak una pray sey, e nor go bi for Sabat Day or Rainin Season naim all dis tins go hapun,

21 bikos for dat taim, di sofa wey go dey, go strong pas eni sofa wey don hapun since wen God kreate di wold kom rish naw and dis kaind sofa, nor go dey again.

22 “And if God nor reduce di days wen dis tins go hapun, evribodi go die finish. Bot bikos of di pipol wey God shuz, e go reduce di days.

23 “So if enibodi kon tel una sey, 'Luk o-o, Kraist dey here or e dey der!' Mak una nor biliv am.

24 “Lia-lia mesayas and profets go kom du big-big mirakols tak disiv pipol. If e posibol sef, dem go disiv pipol wey God shuz.

25 “Mak una rimemba wetin I dey tel una so, bifor dem go hapun.

26 “So if enibodi tel una sey, "Luk, Kraist dey insaid bush,' mak una nor go, or 'Luk, e dey insaid haus,' mak una nor biliv.

27 “Jos as thunda lite dey kom from east go west, na so e go bi wen Man Pikin go kom.

28 “Bikos na wer dead bodi dey, na der vultures dey gada put. “

29 “Afta di wahala wey go hapun for dat taim, di sun go kon dak and di moon nor go shine; stars go fal from hevun and hevun go dey shake.

30 “Den Man Pikin sign go apier for hevun and all di tribes for dis wold, go krai. Dem go si God Pikin dey kom from insaid di kloud for hevun wit pawa and beta glori.

31 “God go send en angels go blow loud trumpet and dem go gada di pipol wey e shuz from evriwer for di wold. “

32 “Mak una hear di parabol abaut fig tri: Enitaim en bransh dey bring leaf kom out, pipol go no sey dry season don near.

33 “So wen una si all dis tins dey hapun, mak una no sey di taim don rish and e dey near una domot.

34 “I tel una tru wod, di pipol wey dey di wold for dis taim, nor go die finish bifor all dis tins go hapun.

35 “Hevun and eart go vanish, bot my wod go stil dey.

36 Nobodi no dat day or di taim, ivun di angels for hevun nor no am, esept my Papa.

37 “Jos laik e hapun for Noah taim, na so Man Pikin go tak kom.

38 “For Noah taim, bifor di flood kom, pipol dey chop and drink, dey mari and dey giv dia pikin out for marage, ontil di day wen Noah enta di ark.

39 “Dem nor no wetin dey hapun ontil wota kom kari dem go. Na laik dat e go bi wen Man Pikin go kom.

40 “Dat taim, tu men go dey for farm; won go vanish liv di oda won.

41 “Tu wimen go dey grind corn for engine, won go vanish liv di oda won.

42 “So, mak una shine una eye, bikos una nor no di day wen Kraist go kom.

43 “Bot mak una rimemba sey: If pesin wey get haus no di taim wen tif go kom for nite, e go redi ensef mak di tif nor for enta en haus.

44 “So, mak una dey redi, bikos Man Pikin go kom for di taim wen una nor tink sey e go kom. “

45 “Hu bi di savant wey wise and gud? Na di pesin wey en oga mak lida among di oda savants, to giv dem fud for di koret taim.

46 “E go gud for dat savant wen en oga go kom bak and e si-am dey wok.

47 “I tel una tru wod, di oga go sey, 'Mak yu kare for di hol haus.'

48 “Bot if na wiked savant, e go tel ensef, 'My oga nor go kwik kom bak',

49 so e go bigin beat di oda savants and e go dey chop and drink wit drunkards.

50 “Wen di oga go kom bak for di day wen di savant nor espet and di taim wen e nor no,

51 e go kut di savant to pisis kon trow am put for wer pritendas dey, wer e go dey krai and grind en tit."

Open Bible reader