Nigerian Pidgin Bible
Mark 8
1 Dat taim, plenti pipol gada and nor-tin dey for dem to chop. So Jisos kon kol en disaipols tel dem,
2 "I dey sori for dis pipol, bikos dem don dey here wit mi for tiri days naw and dem nor get enitin to chop.
3 "If I send dem go wit hunga, dem go faint for road and som of dem kom from far place."
4 Jisos disaipols kon sey, "Wer pesin go fit si bread buy wey go rish dis pipol chop, since pipol nor dey stay dis place wey bi desert?"
5 Jisos ask dem, "Haw meni bread una get?" Dem ansa, "Na sevun."
6 Den Jisos sey mak di pipol sidan for groun. Afta e tak di sevun bread tank God, e kon divide am giv en disaipols, sey mak dem share am for di pipol.
7 Dem stil get som smol-smol fish tu and afta Jisos don tank God, e kon tel en disaipols mak dem share am for di pipol tu.
8 Evribodi chop beleful and di won wey dem gada, ful sevun basket.
9 All di pipol wey chop rish for tazon men. Den, Jisos kon send dem go haus.
10 En and en disaipols kon enta boat go Dalmanuta aria.
11 Di Farisi pipol kon dey argue wit Jisos sey mak e show dem sign from hevun, bikos dem won trai am.
12 Jisos kon ask dem, "Why pipol for dis wold naw dey ask for sign? Mak I tel una tru wod, dem nor go get eni sign".
13 Den e kon liv dem enta boat go di oda side.
14 Jisos disaipols forget to tak bread join di wons wey dey wit dem insaid di boat.
15 Jisos kon tel dem, "Mak una shine una eye, so dat una go gaid unasef against di Farisi pipol and Herod yist!"
16 So, dem kon dey tok to ish oda abaut di bread wey dem nor tak folo bodi.
17 Wen Jisos no wetin dem dey tok, e kon tel dem, "Why una dey tok abaut bread wey una nor tak? Una nor dey si or undastand? Na so una foolish rish?
18 "Una get eye, bot una nor fit tak am si? Una get ear, bot una nor fit tak am hear? Una nor dey rimemba enitin at-all?
19 "Wen I divide faiv bread for faiv tazon pipol, haw meni basket una gada wen di pipol don chop finish?" Dem ansa, "Na twef."
20 "Den, wen I divide sevun bread for for tazon pipol, haw meni basket una gada wen di pipol don chop finish?" Dem ansa, "Na sevun."
21 Den Jisos tel dem, "Una neva stil undastand?"
22 Wen dem rish Betsaida, dem bring won man wey nor dey si kom mit Jisos mak e tosh am.
23 E hol di man for hand kon tak am go outsaid di vilage. Jisos spit for di man eye kon tosh am, den ask am, "Yu dey si enitin?"
24 Di man luk up kon sey, "Yes, I dey si pipol, bot dem bi laik tri wey dey waka abaut."
25 Jisos tosh di man eye again. Di man eye kon opun and e kon dey si wel-wel.
26 E kon tel di man mak e dey go en haus, bot e warn am sey, "Mak yu nor go insaid di vilage again."
27 Jisos and en disaipols kon go di vilage dem wey dey Sizeria Filipai. As dem dey go for road, e kon ask en disaipols, "Na hu pipol dey sey I bi sef?"
28 Dem kon sey, "Som sey yu bi Jon di Baptist, odas sey, yu bi Elija and som stil sey, yu bi won for di profets."
29 Jisos kon ask dem, "Bot hu una sey I bi?" Pita kon ansa, "Yu bi di Mezaya."
30 Den e warn dem mak dem nor tel enibodi hu e bi.
31 Den Jisos bigin tish dem sey, "Man Pikin must sofa meni tins, bikos di eldas, prist oga dem and di law tishas go kil-am and afta tiri days, e go wak-up from deat.
32 As e nor hide dis tins from dem, Pita kol am go kona kon tel am, "Wetin yu dey tok so nor gud o-o."
33 Bot Jisos turn luk en disaipols kon shaut for Pita, "Satan! Mak yu go my bak, bikos yu nor put yor maind for wetin God wont. Na wetin humanbin wont, na der yor maind dey."
34 Den Jisos kol di pipol wit en disaipols kon tel dem, "If enibodi won folo mi, e must denai ensef, kari en kros, den kon folo mi.
35 "Bikos enibodi wey won save en life, go luz am and enibodi wey luz en life bikos of mi and dis gospol, go save am.
36 "Wetin pesin go gain if e get di hol wold and e luz en soul?
37 "Wetin pesin fit yuz tak eshange en life?
38 "If enibodi shame for mi and wetin I dey tish for dis wold wey wiked and ashawo pipol dey, Man Pikin go shame for am tu, wen e go kom bak for en Papa and en holi angels glori.