Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Leviticus 2

1 When anyone dey present grain offering to God, make he first grind am to flower, he go put olive oil and incense on am

2 and bring am to Aaronite priest. The priest go take handful of the flower and oil and all the incense and burn am on top altar like say them done offer everything to God. The smell of the food offering dey please God.

3 Na priest get the rest of the grain offering, he dey holy since dem take am from food wey them offer to God.

4 If the offering na bread wey dem bake inside oven, make e no get yeast. E fit be thick bread wey dem make with flower make them mix with olive oil or biscuit with olive oil.

5 If the offering na bread wey them cook on griddle, make dem make am with flower wey dem mix with olive oil, but make e no get yeast.

6 Break am into pieces and pour olive oil on top am when una dey present am for offering.

7 If the offering na bread wey them cook inside pan, make them make am with flower and olive oil.

8 Bring am to God as offering and present am to priest wey go take am to altar.

9 The priest go take part of am as token like say na everything dem done offer to God and he go burn am on top altar. The smell of the food offering dey please God.

10 Na priest get the remaining; e dey very holy, since dem take am from food wey dem offer to God.

11 Make una no take any of the grain wey una dey present to God with yeast; make una no use yeast or honey for food wey una dey offer God.

12 Make una dey bring offering of first corn wey una harvest each year to God, but make una no burn am on top altar.

13 Make una dey put salt on every grain offering, because salt dey represent the covenant wey dey between una and God. Make una dey put salt on all una offerings.

14 When una dey bring offering of first corn wey una harvest to God, make una offer roasted grain or grind mill.

15 Put olive oil and incense on am.

16 The priest go burn that part of the food and oil wey go serve as token, and the incense, and present am as food offering to God.

Open Bible reader