Nigerian Pidgin Bible
John 15
1 "Na mi bi di koret vine and na my Papa bi di gardina.
2 "E dey kut evri bransh wey nor dey bear frut for my bodi komot and e dey ripair evri bransh for my bodi wey dey bear frut, so dat e go bear more frut.
3 "Una dey klin alredi, bikos of di wod wey I tel una.
4 "Mak una dey insaid mi, so dat I go dey insaid una tu. As di bransh nor fit bear frut wit en own pawa, unles e dey insaid di vine plant, na so una nor go fit bear frut, unles una dey insaid mi.
5 "Na mi bi di vine and na una bi di bransh dem. Di pesin wey stay insaid mi and I stay insaid am, go bear plenti frut, bikos witout mi, una nor go fit du enitin.
6 "Enibodi wey nor stay insaid mi, go dry and pipol go gada en bransh dem, trow dem insaid fire kon burn dem.
7 "If una stay insaid mi and my wod dey insaid una, enitin wey una ask, I go du-am for una.
8 "My Papa go get big onor if una bear plenti frut, wey go show sey una bi my disaipols.
9 "As my Papa luv mi, na so I luv una tu, so mak una liv di kaind life wey go let mi fit luv una more-more.
10 "If una du wetin I tok, I go luv una, jos as I dey obey wetin my Papa tok and E luv mi.
11 "I don tel una all dis tins, so dat my joy go dey insaid una and una joy go ful wel-wel.
12 "Dis na di komand wey I giv una sey, 'Mak una luv ish oda di way I luv una.'
13 "E nor get luv wey big rish di won wey mak pesin die for en frend.
14 "Una go bi my frend if una du wetin I tok.
15 "I nor go kol una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey du, bot I dey kol una my frend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.
16 "Nor bi una shuz mi, bot na mi shuz una. Bikos of dat, I don giv una pawa to bear frut wey go last, so dat my papa go giv una enitin wey una ask am for my name.
17 "Wetin I dey tel una bi sey, 'Mak una luv ish oda.'"
18 "If pipol for dis wold hate una, mak una rimemba sey na mi dem first hate.
19 "If una bi frend wit di pipol for dis wold, dem go luv una as dia own pipol. Bot una nor bi dia frend, bikos I don shuz una from di wold, naim mak dem nor laik una.
20 "Mak una rimemba wetin I tel una, 'Savant nor dey big pas en oga.' If dem sofa mi, den dem go sofa una tu. If to sey dem obey my wod, dem go obey una own tu.
21 "Since dem nor no di Pesin wey send mi kom, dem go du all dis tins to una bikos of my name.
22 "If to sey I nor kom tok to dem, dem for nor dey guilti for dia sin. Bot naw, dem nor get eni eskius for dia sin.
23 "Di pesin wey hate mi, hate my Papa tu.
24 "If to sey dem nor si di mirakol wey I du, wey nobodi don du bifor, dem nor for dey guilti for dia sin. Bot afta dem don si di mirakols, dem stil hate mi and my Papa.
25 "All dis tins hapun, so dat wetin God law tok, go bi tru sey, 'Dem nor get rizin to tak hate mi.'
26 "Bot wen di tru Spirit wey I go send from my Papa to help una don kom, e go tok abaut mi.
27 "And unasef go tok abaut mi, bikos una dey wit mi from di biginin."