Nigerian Pidgin Bible
Job 8
1 Bildad from Shuah con answer say:
2 How long you go talk like that? Your words na nothing but air.
3 God no dey twist justice; him no dey fail to do wetin dey right.
4 Your children fit don sin against God, so him dey punish them as dem deserve.
5 But turn now make you beg Almighty God,
6 If you dey so honest and pure, then God go come help you and return your household as reward.
7 All the wealth wey you don lose go be nothing to wetin God go give you then.
8 Ask those wey don old no, find out the truth wey our ancestor learn.
9 Our life dey short, we no know anything at all; we dey pass like shadow on top earth.
10 But make you allow the old wise people teach you; listen to wetin dem wan talk:
11 Grass no fit grow for where water no dey; you no fit see them outside swamp.
12 If the water dry up, na dem go first dry, and dem go dey too small reach wetin person fit cut and use.
13 Those wey no get God be like grass; their hope don go, once dem forget God.
14 Dem dey trust thread wey be spider web.
15 If dem rest on top web, shey e go fit hold them? If dem grab thread, shey e go fit help them stand?
16 Evil people dey grow like weed for sun, like weed wey dey spread all around garden.
17 Their root dey wrap round stone and e dey hold every rock well.
18 But make you pull them up - nobody go know say dem ever dey there.
19 Yes, na all the joy wey evil people get be that; other dey come take their place.
20 But God no go abandon those wey dey faithful or help evil people.
21 Him go allow you laugh and shout again,
22 but him go bring disgrace on those wey hate you, and the house of the wicked go perish.