Nigerian Pidgin Bible
Job 42
1 Job con answer God:
2 He talk say, God, I know say you be Almighty; I know say you fit do everything wey you want.
3 You been ask why I try question your wisdom when I dey ignorant. I dey talk about something wey I no understand, about wonderful things wey dey too great for me to know.
4 You tell me say make I listen when you dey talk and make I try answer your question.
5 Na only wetin others tell me I know for past, but now I don see you with my own eyes.
6 So I dey shame for everything wey I don talk and I repent as I dey siddon for dust and ashes, I promise say I go change my heart and life.
7 After God don finish to dey follow Job talk, he tell Eliphaz, I dey vex with you and your two friends, because una no talk truth about me, like the way my servant Job don do.
8 Now make una take seven bull and seven ram to Job and make una offer them as sacrifice for unaself. Job go pray for una, and I go answer him prayer and I no go disgrace una as una deserve, una no talk true about me as he don do.
9 Eliphaz, Bildad, and Zophar do wetin God tell them make dem do, and God answer Job prayer.
10 Then, after Job don pray for him three friends, God make him prosper again and he give him double of wetin him get before.
11 All Job brother and sister and former friend come visit him and dem celebrate with him for him house. Dem show their sympathy and dem comfort him for all the trouble wey God don bring on top him. Each of them give him money and gold ring.
12 God bless last part of Job life pass wetin him bless him for beginning. Job get 14,000 sheep, 6,000 camel, 2,000 cattle and 1,000 donkey.
13 Him also get seven son and three daughter.
14 He call the first daughter Jemimah, the second Keziah, and the smallest Keren Happuch.
15 No other women dey for the whole world wey dey beautiful like Job daughters. Their father give them share of the inheritance as he give their brother.
16 Job live for hundred and forty years more, wey dey long enough for him to see him grandchildren and great-grandchildren.
17 And he con die for very good age.