Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Job 4

1 Eliphaz from Teman talk say, Job, shey you go vex if I talk?

2 I no fit keep quiet again.

3 You don teach plenty people and you don give strength to those wey dey weak.

4 When person fall, weak and tire, your word dey encourage him to stand.

5 Now na your turn to dey for trouble, and you dey shock to face am.

6 You worship God, and your life no get blame; and so make you get confidence and hope.

7 Shey you fit think of any innocent person wey don ever perish?

8 I don see where people dey farm field of evil and plant wickedness like seed; now dem dey harvest wickedness and evil.

9 God use vex destroy them, like storm.

10 Wicked people dey shout like lion, but God silent them and break their teeth.

11 Dem die like lion wey no get anything to kill and chop, and all their pikin scatter.

12 I hear a message wey dey quiet, my ear catch am like whisper.

13 E dey disturb my sleep like nightmare.

14 I dey shake; all my body dey vibrate with fear.

15 I feel light breeze touch my face, and the hair wey dey my skin rise up!

16 I dey see something dey stand for there; I look am, but I no know wetin e be. I con hear a voice tell me say.

17 “Anybody fit dey righteous for God eye or dey pure for him Creator front?

18 God no trust him servant wey dey heaven, he dey even find fault with him angel.

19 You think say him go trust creature wey him make with clay, something wey be dust wey fit destroy like moth?

20 Person fit dey alive for morning, but die before evening and nobody go even know.

21 He go lose everything wey him get; he go die before he gain wisdom.”

Open Bible reader