Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Isaiah 61

1 Almighty God don fill me with him spirit. He don choose me and send me make I bring good news to the poor, make I heal the the people wey dey for sorrow, make I announce release to slaves and freedom to those wey dey for prison.

2 He don send me make I announce say the time don come when God go save him people and destroy their enemy. He don send me make I comfort those wey dey mourn,

3 He don send me make I give joy and happiness to those wey dey cry for Zion instead of sadness, make I give them song of praise instead of sorrow. Dem go be like trees wey God don plant by himself. Dem go all do wetin dey right, and dem go praise God for wetin he don do.

4 Dem go rebuild cities wey don destroy for long.

5 My people, foreigners go serve una. Dem go take care of una flocks and farm una land and una vineyards.

6 And dem go know una as priests of the LORD, servant of God. Una go enjoy wealth of the nations and una go dey pride say na una own.

7 Una shame and disgrace don end, una go dey live for una own land, and una wealth go double; una joy go last for ever.

8 God talk say, “I love justice and I hate oppression and crime. I go reward my people faithfully and make everlasting covenant with them.

9 Dem go dey famous among nations; everyone wey see them go know say dem be people wey I don bless.”

1 Jerusalem, celebrate because of wetin God don do. She be like bride wey don dress for her wedding. God don cloth her with salvation and victory.

1 As e dey sure say seed dey germinate and grow, the Almighty God go make righteousness and praise grow for all nations.

Open Bible reader