Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 60
1 Arise, Jerusalem, and make una shine like sun; the glory of God dey shine on top you!
2 Darkness go cover other nation, but the light of God go shine upon you; the brightness of him presence go dey with you.
3 Nations go come to your light, and kings go come to your brightening day.
4 Make una look around and see wetin dey happen: una people dey gather to come home! Una son go come from far away; dem go carry una daughter like children.
5 Una go see this and joy go full una heart; una go shake with happiness. Dem go bring wealth of other nations to una; their riches go come from across the sea.
6 Great of caravans of camel go come from Midian and Ephah. dem go bring gold and incense from sheba. People go tell the good news about wetin God don do!
7 Dem go bring all the sheep of Kedar and Nebaoith to una as sacrifice and offer them on top altar to praise LORD. God go make him Temple glorious pass before.
8 Wetin be all these ships wey dey float like cloud, like dove wey dey return go home?
9 Dem be ship wey dey come from far land, wey dey bring people of God come home. Dem dey bring silver and gold with them to honour the name of LORD, the holy God of Israel, wey don make all the nations honour him people.
1 God tell Jerusalem say, Foreigners go build una wall, and their kings go serve una. I don punish una when I dey vex, but now I go show una my favour and mercy.
1 Una gate go dey open day and night, so that kings of nation fit bring their wealth to una.
1 But nations wey no gree serve una go perish.
1 Jerusalem Dem go bring the wood of the pine, the juniper, and the cypress to rebuild you, the wood wey fine pass from Lebanon forest, to use make my temple fine, and make my city glorious.
1 The descendant of those wey don oppress una go come and bow down to show their respect for una. People wey hate una before go come bow down worship una. Dem go call una, city of God, Zion, city of holy God of Israel.
1 People no go reject and hate una again, city wey don empty and destroy. I go make una great and beautiful, I go make una place of joy for ever and ever.
1 Nations and kings go care for una as mother dey nurse hin pikin. Una go know say I, the LORD, I don save una, say the Almighty God of Israel don set una free.
1 I go bring una gold instead of bronze, silver and bronze instead of iron and wood, and iron instead of stone. Una rulers no go oppress una again; I go make them rule with justice and peace.
1 Una no go hear sound of violence again; Destruction no go scatter una country again. I go protect and defend una like wall; una go praise me because I don save una.
1 Sun no go be una light for day or moon be una light for night; I, the LORD, I go be una everlasting light; the light of my glory go shine on una.
2 Una day of sorrow don end. I, the LORD, I go be una everlasting light, wey dey last pass the sun and moon.
2 All Una people go do wetin dey right, and dem go possess the land for ever. Na me plant them, i make them to dey show my glory to everybody..
2 Even una family wey small and humble pass go become great like powerful nation. I go make this happen quickly, when the right time com. Na me be the LORD!