Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Isaiah 59

1 Make una no think say God too weak to save una or too deaf to hear una call for help!

2 Na una sins no make him hear una. Na una sin separate una from God when una try worship him.

3 Una dey guilty of lying, violence, and killing.

4 Una go court, but una no dey get justice for una side. Una depend on lies to win case. Una carry out una plans to hurt others.

5 The evil wey una don plan dey terrible like eggs of snake wey get poison.

6 Break egg, na snake come out! But una plan no go do una any good- dem dey useless like cloth wey dem use cobwebs make!

7 Una dey always plan evil things, and una no fit wait to dey do am. una no dey wait to dey kill innocent people. Una dey leave trouble and destruction for everywhere una go,

8 And no one dey save when una start. Everything wey una dey do no dey right. Una dey follow evil way, and no one wey walk for that way go ever dey safe.

9 The people talk say, “Now we know why God no save us from those wey oppress us. We dey hope for light to use walk, but na only darkness dey,

1 And we dey look around like blind people. We dey fall for afternoon, like say na night, like say we dey for dark world of dead.

1 We dey fear and suffer. We dey wait make God save us from oppression and weong, but nothing don happen.

1 “God, our crime against you plenty. Our sins dey accuse us. And we know them all.

1 We don rebel againt you, we don reject you, and we don refuse to follow you. We don oppress others and we don turn away from you. Our thought na fake; our words na lie.

1 Justice don go away, and right no fit come near. Truth don fall for public square, and honest no see place for there.

1 No little honesty dey and those wey stop to dey do evil con become victim of crime.”God don see this, and he pain him say justice no dey.

1 E surprise him say no one dey wey fit help the oppressed. So he go use him own power take rescue them and go use him power to win the victory.

1 He go wear justice like coat of armour and saving power like helmet. He go cloth himself with strong desire to set things right and to punish and he go take revenge for the sin wey people don suffer.

1 He go punish him enemy according to wetin dem don do, even those wey dey live for far lands.

1 Everyone go fear him and him great power from east go west. He go come like rushing river, and like strong wind.

2 God tell him people say, “I go come Jerusalem to defend una and to save all of una wey turn from una sins.

2 And I go make covenant with una: I don give una my power and my teachings make dem be una own forever, and from now on make una dey obey me and make una teach una children and una descendant to obey me for all time to come.”

Open Bible reader