Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 57
1 Good people die, and no one dey understand or dey even care. But when dem die, no trouble fit wound them.
2 Those wey live good lives go find peace and rest when dem die.
3 Una sinners, make una come here for judgement! Una no better pass witch, adulterers, and prostitute.
4 Who una dey make fun of? Who una liars dey mock?
5 Una dey worship the fertility gods by having sex under those una holy trees. Una offer una children as sacrifice for the rocky cave near river.
6 Una take smooth stones from there and una dey worship them as gods. Una pour out wine as sacrifice to them and una bring grain offerings to them. Shey una hink say I dey happy with all this?
7 Una go high mountain go offer sacrifice and have sex.
8 Una set up una dirty idols just inside una front doors. Una reject me; una remove una clothes and climb to una large bed with una lovers, wey una pay to sleep with una and una satisfy una sexual desire for there.
9 Una spray una perfume and ointments and una go worship god of Molech. To find god worship, una send una messenger go far and wide, even go world of the dead.
1 Una stress unaselves to dey look for other gods, but una no dey give up. Una think say una dirty idols dey give una strength, and so una grow weak.
1 God talk say, Who be these idols wey dey scare una, so that una dey lie to me and forget me completely? Shey una don stop to dey honour me because I dey silent for so long?
1 Una think say wetin una dey do dey right, but I go expose wetin una dey do, and una idols no go fit help una.
1 When una cry for help, make una idol come save una! Na wind go carry them commot! But those wey trust in me go live in the land and dem go worship me for my Temple.
1 God talk say, make my people return to me. Make una remove every obstacle from their way! Make una build the road, and make am ready!
1 I be the high and Holy God, wey dey live for ever. I dey live for high and holy place, but I also dey live with people wey dey humble and wey repent from their sin, so that I fit restore their trust and hope.
1 I don give life to my people, and I no go continue to dey accuse them or dey vex with them for ever.
1 I dey vex with them because of their sin and long throat before, na so I punish and abandon them. But dem get strong head and continue dey go their own way.
1 I don see how dem behave, but I go heal them. I go lead and help them, and I go comfort those wey dey cry.
1 I don give peace to all, both near and far! I go heal my people.
2 But evil people be like sea wey no get rest, wey hin wave no stop to dey roll , e dey bring dirty and waste.
2 God talk say, Safety no dey for sinners.