Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Isaiah 55

1 God talk say, “Make una come, everyone wey need water, water dey here! Make una come, una wey no get money- make una buy corn and chop! Make una come! buy wine and milk- e no go cost una anything!

2 Why una dey spend money on top something wey no go ma? Why una dey spend una money and still dey hungry? Make una listen to me and do wetin I talk, and una go enjoy food wey better pass.

3 “hear me now, my people, and make una come back to me; make una come to me, and una go get life! I go make covenant wey go last with una and I go give una blessing wey I promise David.

4 Na me make him leader and commander of nations, and I show them my power through him.

5 Now make una gather foreign nations; dem no know una before, but now dem go turn to join una! I, the LORD una God, the holy God of Israel, go make this happen; I go give una honour and glory.”

6 Make una turn to God and pray to him, now wey he dey near.

7 Make the wicked leave their way of life and change the way dem dey think. Make dem turn to the LORD, our God; he dey merciful and he dey quick to forgive.

8 God talk say, “My thought”, “No dey like una own, and my way dey different from una own.

9 As heaven dey high above earth, naso my thought high pass una own.

1 “My words be like snow and rain wey dey come from the sky to water the earth. Dem dey make the crop to dey grow and provide seed to dey plant and food to dey chop.

1 Naso a the word wey I don also speak go be- e no go fail to do wetin I plan for am; e go do everything wey I send am make e do.

1 “Una go live Babylonia with joy; una go leave the city in peace. The mountains and hills go start to dey sing, and the trees go shout for joy.

1 Cypress tree go grow for where wild rose dey now; myrtle trees go grow to replace thorns . This go be the sign wey go last forever, a reminder of wetin I, the LORD, don do.”

Open Bible reader