Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 51
1 God talk say, Make una listen to me, una wey wan dey save, una wey come meet me for help. Make una think of the rock wey una come from, the place wey dem make una.
2 Make una think of una ancestor, Abraham, and Sarah, where una come from. Abraham no get pikin when I call him, but I con bless him and give him children; I make him descendant plenty.
3 I go pity Jerusalem, I go pity those wey dey live for hin empty land. Though her land na desert, I go turn am to garden, like garden wey I plant for Eden. Joy and happiness go dey for there, and songs of praise and thanks to me.
4 My people, Make una listen to me, make una listen to wetin I talk: I dey give my message to nations; my laws go bring light to them.
5 I go come quickly and save them; the time of my victory don near. I go rule over the nation myself. Far land dey wait for me make I come; dem dey wait with hope for me to save them.
6 Make una look up to heavens; make una look the earth! The heaven go disappear like smoke; the earth go spoil like old cloth, and all him people go die like flies. But the deliverance wey I bring go last forever; my victory go be final.
7 make una listen to me, una wey know wetin dey right, una wey get my message for thehearts. Make una no fear when people mock and insult una;
8 Dem go disappear like cloth wey moth don chop! But deliverance wey I bring go last forever; my victory go dey for all time.
9 LORD, Wake up, make you help us! Make you use your power and save us; use am as you don do for old times. Na you cut the sea monster Rahab to pieces.
10 Na you also dry up the sea and make way through water, so that those wey you dey save fit cross.
11 People wey you don rescue go teach Jerusalem with happiness, them go dey singing and go shout for joy. Dem go dey happy forever, dem go dey free from sorrow and pain forever.
12 God talk say, Na me be the one wey dey give una strength. Why una go fear human being, wey no strong pass grass again?
13 Shey una don forget the LORD wey make una, wey stretch out out heavens and lay the foundation of the earth? Why una go dey live for fear of anger of those wey oppress una, those wey dey ready to destroy una? Their anger no fit touch una again.
14 Those wey be prisoners go soon get freedom; dem go live long life and dem go get all the food wey dem need.
15 I be the LORD una God; I disturb sea and I make hin waves shout. Na Almighty God be my name!
16 Na me stretch out heaven and lay foundation of the earth; I tell Jerusalem say, Una be my people! I don give una my message, and I don use my hand protect una.
17 Jerusalem, wake up! Make una rise and get up! Una don drink the cup of punishment wey God give una to drink when e dey vex; una don drink am go down, and e don make una stagger.
18 Nobody dey to lead una, nobody among una people to hold una for hand.
19 Double trouble don fall on una: war don destroy una land, and hunger don wire una people. Nobody dey to pity una.
20 For every corner of the street una people dey collapse from weakness; dem be like deer wey hunter net catch. Dem don feel the force of God anger.
21 Una people of Jerusalem wey dey suffer, una wey stagger like say una don high,
22 The LORD una God dey defend una and talk say, I dey take away the cup wey I give una when I dey vexin my anger away. Una no go need drink the wine wey make una stagger again.
23 I go give am to those wey oppress una, to those wey make una lie down for streets and waka on top una like say una be dirty.