Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 46
1 Na the end for Babylonia god be this! Dem dey worship Bel and Nebo before, but now dem dem load on top donkey, dem be trouble for back of animals wey don tire.
2 The idols no fit save themselves; dem don capture and carry them away. Na the end for Babylonia gods be this!
3 Make una hear me, descendants of Jacob, all those wey remain from my people.i don care for una from the time wey dem born una.
4 I be una God and I go take care of una until una don old and una hair don turn grey. I made una and care for una; I go help una and I go rescue una.
5 God talk say Who una go compare me with?. Shey anyone else dey like me?
6 People dey open their purses and dey commot gold; dem dey weigh silver on top scale. Dem hire goldsmith make he make god; then dem bow down to worship am!
7 Dem lift am up for their shoulder and carry am; dem put am for and e dey stand for there, and e no fit move from where e dey. If anyone pray to am, e no fit answer or save am from disaster.
8 Make una remember this, una wey be sinners; make una consider wetin I don do.
9 Make una remember wetin happen long ago; make una apprieciate say I alone be God and say no one else dey like me.
10 Na from beginning I don predict the outcome; e don tey wey I don talk wetin go happen. I talk say my plans no go fail, say I go do everything wey I talk say I go do.
11 I dey call a man to come from the east; he go fly down like hawk and he gocarry out wetin I don plan. I don talk, and na so e go happen.
12 Make una listen to me, una people wey get stong head wey think say victory dey far.
13 I dey bring the day of victory near- e no dey far at all. My victory no go delay. I go save Jerusalem and I go bring honour to Israel for there.