Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Isaiah 23

1 Na the message about Tyre be this. Make una cry with sorrow u sailors wey dey on top ocean! Una home Tyre don destroy; hin house and hin place don destroy.as una ship dey return from Cyprus, una hear the news.

2 Make una cry, una traders of Sidon! Una send men

3 Across the sea make dem go buy and sell corn wey grow for Egypt and make them do business with all the natons.

4 City of Sidon, shame don catch una! The sea and great ocean depth don disown una and e talk say, “I never get any children. I no raise any sons or daughter.”

5 Even people of Egypt go shock and fear when dem hear say Tyre don destroy.

6 Make una cry with sorrow, una people of Phoenicial! Make una try escape go Spain!

7 Shey na joyful city of Tyre, wey dem create long ago be this? Shey na the city wey send people across the sea make dem establish territory be this?

8 Who be the person wey plan to bring this kind thing on top Tyre, that royal city, wey hin merchant prince na the one wey get honour pas on top earth?

9 Na Almighty God plan am. he plan am so that he fit end their pride for wetin dem don do and so that he fit turn their honour to shame

1 Make una go farm the land, una people wey dey the colonies in for Spain! No one wey go protect una again.

1 God don stretch him hand over the sea and he don take over kingdom. He don order say make dem they destroy the Phoenician centres of commerce.

1 City of Sidon, una happiness don end, and una people dey under abuse. Even if dem escape go Cyprus, dem no go dey safe.

1 {Na Babylonians allow wild animal attack Tyre no be Assyrians. Na Babylonia put siege tower, them destroy the strong wall of Tyre, and destroy the city.}

1 Make una cry with sorrow, una sailors wey dey on top oceans! The city wey una dey put hope don destroy.

1 Time dey come when people go forget Tyre for seventy years, the life time of a king. When those years don pass, Tyre go be like prostitute for song:

1 Take your harp, and go round the town, you poor prostitute wey men don forget! Make you play and sing your song again so that you go fit bring men back again.

1 When that seventy years don pass, god go con allow make Tyre go back to the trade wey she dey do before, and she go hire herself out give all the kingdoms wey dey the world.

1 The money wey she make she go dedicated am to God. She no go sto am, but those wey worship the LORD go use her money take buy food and clothe wey dem need.

Open Bible reader