Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 22
1 Na message about valley of vision be this. Wetin dey happen? Why all people of the city dey celebrate on top the roof of the houses?
2 The whole city dey in disorder, na noise and excitement full am. Una people wey die for war no die for fighting.
3 All una leaders run away and dem catch them before dem fit shoot one arrow.
4 Now make una leave me make I cry bitterly over those of my people wey don die. Make una no try comfort me.
5 This na time of panic, defeat and confusion for land of valley of vision, and the Almighty God, don send am on top us. The wall of our city don fall down, and cry for help don echo among the hills.
6 Soldiers from land of Elam dey ride on horseback, and dem dey armed with bows and arrow. Soldier from land of Kir don get their shield ready.
7 Na chariot, full the good valley of Judah sodiers on horse back stand for front of Jerusalem gate.
8 All defence of Judah don fall. When e happen like dat, you con bring weapon commot for for where you dey keep armor.
9 You con find the place where wall of Jerusalem need repair.
10 You check all the house wey dey for Jerusalem and you destroy some of them so dat you fit get stone to repair the city wall.
11 You con build reservoir for inside the city to hold the water wey dey flow down from the old pool. So dat you fit store water. But una no pay attention to God, wey don plan this for long and wey make this to happen.
12 The Sovereign LORD Almighty dey call una then shey make una cry and mourn, make shave una heads and make una wear sackcloth.
13 Instead una laugh and celebrate. Una kill sheep and cattle to chop, amd una drink wine. Una talk say, We fit dey chop and drink! We go die tomorrow.
14 Almighty God himself follow me talk and say, them no go ever get forgiveness for this evil as long as them dey alive. I, the sovereign LORD Almighty, don talk.
15 The Sovereign LORD Almighty tell me make I go to Shebna, the manager of the royal household, and tell him say,
16 Who you think say you be? Wetin be the right wey you get to form tomb out of rocky hillside for yourself?
17 You fit dey important, but God go pick you up and he throw away you.
18 He go pick you up like ball and he go throway you inside larger country. Na for there you go die beside the chariot wey you dey proud about. Na shame you be to your master household.
19 God go remove you from the office and he go bring you down from your high position.
20 God tell Shebna say, When e happen like dat, I go con send for my servant Eliakim son of Hilkiah.
21 I go put your official rope and belt on him and I go give him all the authority wey you don get before. He go be like father to people of Jerusalem and Judah.
22 I go give him complete authority under the king, descendant of David. He go get keys of office; anything wey he open, nobody go fit close am, and anything wey he close, nobody go open am.
23 I go hold him well, and he go be source of honour to him family.
24 But all him relative and dependants go be burden to him. Dem go hnag on him like pot and bowls wey dem dey hand from hin peg!
25 When e happen like dat, the peg dey wey hold well well go loose and fall. And na that go be the end of everything wey he hang on am. God don talk.