Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 21
1 Na message about Babylonia be this. Disaster go come from terrible land, like terrible wind dey sweep across the desert.
2 I don see vison of wicked event, vision of betrayal and destruction. Army of Elam, make una Attack! Army of Media, make una lay siege to the cities! God go end the suffering wey Babylon don cause.
3 Wetin I see and hear for vision don give me shock and pain, pain like that woman wey dey for labour.
4 My head dey spin, and fear dey make me dey shake. I don dey hope say make night come, but e no bring me anything but fear.
5 Food don ready inside the vision; dem don spread rug for guest make dem sit on top. Dem dey chop and drink. Na suddenly the command ring out say: Officers! Make una prepare una defence!
6 Then God tell me say, Go make guard, and tell him make he report everything wey he see.
7 If he see two men wey dey come on horseback, two by two, and if he see men wey dey ride on donkey and camels, make he observe dem very well.
8 The guard call out say, Sir, I don dey stand guard for my post day and night.
9 Suddenly, dem don come! Men wey dey on horseback two by two. The guard con give the news say, Babylon don fall! All the idols wey dem worship don scatter for ground.
10 My people Israel, una don scatter like wheat, but now I don announce to una the good news wey I hear from the LORD Almighty, God of Israel.
11 Na message about Edom be this. Person call me from Edom say, Guard, how soon the night go finish? Make you tell me how soon e go end.
12 I answer am say, morning dey come, but night go come again. If you wan ask again, make you come back and ask.
13 Na message about Arabia be this. Una people of Dedan, wey caravans camp for barren country of Arabia,
14 Make una give water to thirsty people wey come meet una. Una people of Tema land, make una give food to strangers.
15 People dey run to escape from the sword wey wan kill them, from the bow wey don dey ready to shoot, from all dangers of war.
16 Then God tell me say, In one year end go come to greatness of kedar tribe.
17 Na the bowmen brave pass among the men of Kedar, but na few of them go remain. I, the LORD God of Israel, don talk.