Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 17
1 God talk say, Damascus no go be city again, e go be a place wey don perish.
2 The cities of Syria go empty for ever dem go be grassland for sheep and cattle, and nobody go drive them away.
3 Israel no go get defence, and Damascus go lose hin freedom.shame go catch those Syrians wey survive like people of Israel. I, the LORD Almighty, don talk.
4 God talk say, A day dey come when greatness of Israel go con end, poverty go replace hin wealth.
5 Israel go be like field wey people don cut hin cut and harvest hin corn, e go dey empty like field wey dey the valley of Rephaim when dem don pick everything.
6 Na only few go survive, and Israel go be like olive tree wey dem don pick the olive except two or three for the top, or few wey dem leave for lower branches. I, the LORD God of Israel, don talk.
7 When that day come, people go turn to their creator for help, the holy God of Israel.
8 Dem no go rely on the altars wey dem make with their own hand, or trust in their own handiwork wey be the symbol the goddess Asherah and alter wey dem dey use burn incense again.
9 When that day come, city wey get good defence go empty and e go destroy like city wey Hivites and Amorites don abandon as dem run commot from people of Israel.
10 Israel, una don forget God wey rescue una and protect una like mighty rock. Instead, una plant garden so that una go fit dey worship foreign god.
11 But even if dem grow and blossom the very morning wey una plant them, harvest no go still dey. Na only trouble and pain wey no get cure go dey.
12 Powerful nation dey cry with sound like shout of the sea, like the crashing of waves wey big.
13 The nations dey advance like rushing waves, but God don rebuke them and dem withdraw, dem run commot like dust wey dey hill side, like straw for terrible wind.
14 Dem cause fear for evening, but dem don go by morning. Na wetin go happen to everyone wey rob our land be that.