Nigerian Pidgin Bible
Hosea 8
1 God talk say, sound the alarm! Enemies dey attack my land like eagle! My people don break the covenant wey I make with them and don rebel against my command.
2 Even though dem call me their God and claim say dem be my people and dem know me,
3 Dem don reject good thing. Because of this their enemy go pursue them.
4 "My people choose king, but them chose them on their own. Dem appoint leaders, but dem no see my approve!. Dem take their silver and gold and make idols - for their own destruction.
5 I hate the gold bull wey people of Samaria city dey worship. I dey vex with them. How long dem go give up on their idols?
6 Na Israelite craftman make the idol, and e no good at all! The gold bull wey dem dey worship for Samaria go be smashed to pieces!
7 When dem sow wind, dem go reap storm! A field of corn wey never mature no fit produce any bread. But even if e produce am, foreigners go chop am.
8 Israel don become like any other nation and dey useless like pot wey don break.
9 Stubborn like wild donkeys, the people of Israel dey go their own way. They don go meet Assyria for help, and dey don pay other nation make dem protect them.
10 But now I go gather them together and punish them. Soon dem go swim in pain, when the emperor of Assyria oppress them.
11 "The more alters wey people of Israel build to remove sin, na the more places dem get to sin!
12 I write down plenty command for the people, but them reject them like strange and foreign.
13 Dem offer sacrifice to me and chop the meat of the sacrifice. But I, the LORD, no dey happy with them, and now I go remember their sin and I go punish them for am; I go send them back go Egypt!
14 "The people of Israel don build palace, but dem don forget their own maker. The people of Judah don build strong city. But I go send fire wey go burn down their palace and their city."