Nigerian Pidgin Bible
Hosea 3
1 God tell me say, make you go again, go show love to the woman wey dey commit adultery with her lover. You must love her as I dey love people of Israel, even though dem turn to other god and like to dey give offerings to idols.
2 Na so I pay fifteen pieces of silver and 1500kilogrammes of barley take buy am.
3 I tell am say she go wait for me for long time wey she no go do prostitute or commit adultery again; and for this time I go wait for her.
4 For this way, people of Israel go dey for long time without kings or leaders, without sacrifices or sacred stone pillars, without idols or images to take do divination.
5 And the time dey come when Israel go turn to the Lord their God, and to a descendant of David wey be their king. And dem go fear God and receive him good gifts.