Nigerian Pidgin Bible
Genesis 49
1 Jacob call him sons and say, "Make una gather round, I go tell una wetin go happen for future.
2 Make una come together and hear me. Sons of Jacob hear una father Israel.
3 Reuben na my first born, na him be my strength, na him be my child wey I first get, na him proud pass and na him dey strong pass out of my sons.
4 He be like a raging flood but no be him go dey important pass because you sleep with my concubine and you no honor your father bed.
5 Simeon and Levi na brothers, dem use their weapon commit violence,
6 I no go join their secret talks and I no go be part of their meetings because them kill men in anger and dem cripple bulls for spot.
7 I dey curse their anger and their wrath because e dey brutal. I go scatter them throughout Israel land and I go scatter them among people of Israel.
8 Judah, your brothers go praise you, you hold your enemies for neck. Your brothers go bow down before you.
9 Judah be like Lion wey dey kill victim and dey go back to him den go stretch and lie down, nobody fit disturb him.
10 Judah go hold royal scepter and him descendants go always hold am until the one wey get am come, the one wey all nations go honour.
11 He tie him young donkey to great vines, best of vines, he wash him clothes inside wine,
12 him mind dey dark pass wine and him teeth dey white pass milk.
13 Zebulun go live beside sea, him sea go be for ships, him territory go reach Sidon.
14 Issachar no better pass donkey wey lie down and stretch between saddlebags.
15 But he see say the resting place dey good and the land dey pleasant. He come bend him back to carry load and dem force am to work as slave.
16 Dan go be ruler of him people, he go be like other tribes of Israel.
17 Dan go be a snake for side of road, poisonous snake for road wey dey strike horse legs so that the horses go throw off the rider for back.
18 God I dey wait for your deliverance.
19 Gang of robbers go attack Gad but he go turn and pursue them.
20 Asher land go produce rich food. E go produce food wey dey fit for a king.
21 Naphtali na deer wey dey run free wey get lovely funs.
22 Joseph be like wild donkey wey dey by river, wild colt for hill side.
23 Him enemies attack with violence and dem pursue him with bow and arrow.
24 But him bow dey steady and him hands don become strong by power of mighty God of Jacob, by shepherd and protector of Israel.
25 Na your God dey help you. Almighty God go bless you with rain blessings from above and rain water from underground. Blessing of many cattle and children, blessings of food and flowers,
26 blessings of ancient mountains, pleasant things from everlasting hills. These blessings go rest for Joseph head who be prince among him brothers.
27 Benjamin be like wolf wey dey devour and kill, morning and evening."
28 Na these be the twelve tribes of Israel and this na wetin their father says as he dey tell each son word of farewell.
29 Jacob come tell him sons say, "Now wey I dey join my people wey don die, make you bury me with my fathers for the cave wey dey field of Ephron the Hittite for Machpelah, east of Mamre for Canaan land.
30 Na Abraham buy the cave and field from Ephron for burial ground.
31 Na there dem bury Abraham and Sarah, na there them bury Isaac and Rebecca, and na there I bury Leah.
32 Na from Hittite dem buy the cave and field, burry me for there".
33 When Jacob don finish to dey give him sons instructions, he come lie down and die.