Nigerian Pidgin Bible
Genesis 47
1 Joseph come go meet Pharaoh and he tell him say my father and my brothers don come from Canaan land, dem don come with their flocks and herds and everything wey them get. Dem don dey for Goshen region.
2 Joseph come take five of him brothers and he present them to Pharaoh.
3 Pharaoh come ask them, "Wetin be una job?"
4 We be shepherds just like our forefathers. We don come to live for Egypt because the famine too strong for Canaan land and pasture no dey for our flocks. I beg allow us make we dey live for Goshen region.
5 Pharaoh come tell Joseph say, "Now wey your father and your brothers don come join you for here,
6 select any place for them. Land of Egypt na their own, make dem settle for best part of Goshen region. If any of them dey strong, make you put them in charge of my livestocks.
7 Joseph come bring him father Jacob and he present am to Pharaoh. Jacob come bless Pharaoh.
8 Pharaoh come ask him, "How old you be?"
9 Jacob reply say, "I don travel earth for
130 hard years but my life never long reach life of my forefathers".
10 Jacob come bless Pharaoh again before he begin dey go.
11 Naso Joseph come give Ramsey region wey be the best land for Egypt to him father and him brothers and dem settle there as Pharaoh don command.
12 Joseph come get food for him father and him brothers and him father family even with the smallest children.
13 The hunger come dey become strong reach say them don finish their food and people come dey hungry throughout Egypt and Canaan land. As dem buy corn,
14 Joseph collect all money and he take am to palace.
15 When dem don finish all money for Egypt and Canaan, Egyptians come meet Joseph and dem say, "Give us food. No allow us die because our money don finish".
16 Joseph come answer, "Bring your livestock, I go give you food in return if your money don finish".
17 Naso dem bring their livestock to Joseph and he give them food in return for their horses, sheep, goat, cattle and donkeys. For that year, he dey give them food in return for their livestock.
18 For the following year, dem come to him and them say, "we no go hide the truth from you say our money don finish and our livestock don belong to you, we no get anything left to give you apart from our bodies and our lands.
19 No allow us die, do something, no let our farm dey useless, buy us and our lands in return for food. We go be king slaves and he go own our land. Give us food wey go keep us alive and seeds wey we go plant for our farm".
20 Joseph come buy all the land wey dey Egypt for the king. Every Egyptians come sell their lands by force because the hunger dey strong and all the lands come become king property.
21 Joseph come make them slaves from one end of Egypt to the other.
22 The only land wey him no buy na the one wey belong to the priests. Dem no need to sell their lands because Pharaoh don give them allowance to dey live on am.
23 Joseph come tell the people say, "Una see say i don buy una and una land for the king, na seed wey you go plant for your farm be this.
24 When harvest time reach, una go give one-fifth to the king, una fit use the rest for seed and make you use am feed your family.
25 Dem come answer, "You don save our lives and you don dey good to us sir and we go be king slaves".
26 Naso Joseph come make am law for the land of Egypt say, "One-fifth of harvest dey go to the king. This law still dey today, only priests land no become king property.
27 Israelites come live for Egypt for Goshen region where dem become rich and dem get plenty children.
28 Jacob come live for seventeen years in Egypt until he come reach one hundred and forty-seven years old.
29 When time don near for him to die, he call him son Joseph and he tell him say, "Put you hand between my thighs and make a vow say you no go burry me for Egypt.
30 I want make una burry me for where my fathers dey. Carry me comot for Egypt and burry me for where dem burry them". Joseph come answer, "I go do as you don talk."
31 Jacob come say "make a vow say you go do am." Joseph come make vow and Jacob come give thanks there for him bed.