Nigerian Pidgin Bible
Genesis 46
1 Jacob pack everything wey him get, he come go Beersheba where he offer sacrifice to God of him father Isaac.
2 God come tell him for vision for night and He call him, "Jacob, Jacob", he come answer, "Yes, I dey here."
3 He come tell him, na me be God, God of your father, no fear to enter Egypt, I go make your descendants a great nation there.
4 I go follow you enter Egypt and I go bring your descendants back to this land, Joseph go dey with you when you die.
5 Jacob come go Beersheba, him son come put him, their children, their wives for wagon wey king of Egypt don send for them.
6 Dem carry their livestock and everything wey dem don get for Canaan and dem go Egypt. Jacob take all him descendants with him.
7 Him sons, him grandsons, him daughters and him granddaughters.
8 Jacob family members wey go Egypt with him na him eldest son Reuben and
9 Reuben sons: Hanoch, Pallu, Hezron and Carmi.
10 Simeon and him sons: Jemuel, Jamin, Ohad, Jachin, Zohar and Shaul wey be son of Canaanite woman.
11 Levi and him sons: Gershon, Kohath and Merari.
12 Judah and him sons: Shelah, Perez and Zerah. Judah other sons, Er and Onan don die for Canaan. Perez sons na Hezron and Hamul.
13 Issachar and him sons: Tola, Puahh, Jashub and Shimron.
14 Zebulun and him sons: Sered, Elon and Jahleel.
15 Na this be the sons wey Leah don born for Jacob for Mesopotamia. Aside him daughter Dinah, all him descendants through Leah na thirty-three.
16 Gad and him sons: Zephon, Haggi, Shuni, Ezbon, Eri, Arod and Areli.
17 Asher and him sons: Imnah, Ishvah Ishvi, Beriah and their sister Serah. And Beriah sons na Heber and Malchiel.
18 This sixteen na the descendants of Jacob by Zilpah the female slave wey Laban give him daughter Leah.
19 Rachel born two sons for Jacob: Joseph and Benjamin.
20 For Egypt, Joseph get two sons: Manasseh and Ephraim wey Asenath daughter of Potiphera a priest wey dey Heliopolis born for him.
21 Benjamin sons na Bela, Becher, Ashbel, Gera, Naaman, Ehi, Rosh, Muppim, Huppim and Ard.
22 These fourteen na the descendants of Jacob through Rachel.
23 Dan and him son, Hushim.
24 Naphtali and him sons: Jahzeel, Guni, Jezer and Shillem.
25 This seven na the descendants of Jacob through Bilhah the female slave wey Laban give Rachel.
26 Total number of Jacob direct descendant wey go Egypt na sixty- six, him son wives no dey for the number,
27 two sons dey for Joseph for Egypt. Na him come make total number of Jacob family wey go there be seventy.
28 Jacob send Judah for front make he go ask Joseph to meet him for Goshen. When dem reach,
29 Joseph come enter him Chariot and he go meet him father for Goshen. When dem meet, Joseph hug him father neck and cry for long time.
30 Jacob come tell Joseph say, "I don ready to die now wey I don see you and I know say you still dey alive".
31 Joseph come tell him brothers and him father family say, "Make I go tell the king say my father, my brothers and my father family wey dey live for Canaan don come to me.
32 I go tell them say, una be shepherds wey dey take care of livestock and una don bring your flocks and herds and everything wey you get.
33 When king call una and ask una say, "Wetin una dey do?"
34 Make una dey sure una tell am say una dey take care of livestock all your lives as your fore-fathers don do. For this way, he go allow una live for Goshen region". Joseph talk am because Egyptians no get anything to do with shepherds.