Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Genesis 4

1 Adam make love to him wife, and she get belle. When she born Cain, she say God don help me get a man.

2 And she born him brother and she name am Abel. When dem grow up, Abel become shepherd and na farmer Cain be.

3 When time of harvest reach, Cain bring some of him crops as gift to God.

4 Abel come bring the best portion of him first born lambs as gift to God. God come accept Abel and him gift,

5 but He no accept Cain and him gift. Na this thing make Cane dey very angry and anger come dey show for him face.

6 God ask Cain, "Why you dey vex and why anger dey show for your face?

7 You go dey accepted if you do wetin dey right, but if you no do wetin dey right, you go see. Sin dey for your door, e wan control you but you go learn how to control am.

8 One day Cain tell him brother, make we go inside farm and when dem dey inside farm, Cain attack him brother and kill am.

9 God come ask Cain, "Where your brother dey? Where Abel dey?" Cain say, "I no know, na me be him guardian?

10 God come say, "Wetin you don do? Hear me, your brother blood dey cry to me from inside ground.

11 Now I don curse you and I don chase you commot from the ground wey swallow your brother blood.

12 The land no go produce good crop for you again no matter how you work. From now you go dey homeless and you go dey waka around the earth.

13 Cain come reply say, "this punishment too much for me to bear.

14 You don send me comot from the land and from your presence, You don make me homeless person wey dey waka around, anybody wey see me go kill me.

15 God come reply say, "No, I go give seven times the punishment to anybody wey kill you." God come put mark on top Cain to warn anyone wey try kill am.

16 Naso Cain leave presence of God and he settle for land of Nod for east of Eden.

17 Cain come make love to him wife and she get belle and born Enoch. Cain come biuld one city and name am after him son, Enoch.

18 Enoch come get one son, he call am Irad. Irad na the father of Mehujael, Mehujael come be the father of Methusael, Methusael come be the father of Lamech.

19 Lamech marry two woman, the first one na Adah and the second one na Zillah.

20 Ada born Jaba who be the first of the people wey dey raise animal and dey live inside tenth.

21 Him brother name na Juba, na him be the first of people wey dey play harp and flute.

22 Lamech other wife, Zillah born a son Tubal-cain. Tubal-cain na blacksmith. Tubal-cain come get a sister Naamah.

23 One day, Lamech tell him wife, "Adah and Zillah, make una hear me. I don kill a man wey attack me, one young mn wey wound me.

24 If the person wey kill Cain get seven times punishment, then the one wey kill me go get seventy times punishmnet.

25 Adam come make love to him wife again, and she born another son. Him name na Seth, she say, "God don give me another son to replace Abel wey Cain kill.

26 When Seth grow up, he get a son and he name am Enosh. At that time, people begin dey worship the LORD by him name.

Open Bible reader