Nigerian Pidgin Bible
Genesis 33
1 Jacob come look up and he see Esau as he dey come with him four hundred men. Naso he divide him children among Leah, Rachael and him two servant wives.
2 He come put the servant wives and their children for front. Leah and her children next and Racheal and Joseph last. Jacob come dey ahead of them.
3 As he aproach him brother he begin dey bow for ground seven times before him.
4 Esau come run to him and he embrace him. He hug him and kiss him. Both of them come begin dey cry.
5 Esau come look at the women and the children, he come ask, "Who be these people wey dey with you?" Jacob come reply, "Na the children wey God don give to me your servant."
6 The servant wives come forward with their children and dem bow before him.
7 Leah and her children come bow down before him too, and finally Joseph and Rachael come forward and dem bow before him.
8 Esau come ask, "Wetin be the flocks and herds wey I meet as I dey come?" Jacob come reply say, "Dem be gifts for you my lord, so that you go fit dey friendly to me."
9 Esau come answer him, "My brother, I get plenty, keep wetin you have for yourself.
10 But Jacob insist say, "No, if I don get favour from you, abeg accept these gifts from me. I dey happy as I dey see your friendly smile, e be like say I dey see the face of God.
11 Abeg take these gifts wey I don bring for you because God don dey gracious to me, I get more than enough." Because Jacob insist, Esau come finally accept the gifts.
12 Esau say, "Make we dey go, I go lead the way."
13 Jacob come reply, "My lord, as you dey see say, some of my children still dey very young and the flocks and herds too get young ones. If we drive them too hard even for one day, all of the animals fit die.
14 Abeg my lord, dey go for front of your servant, we go dey follow you slowly at a pace wey dey comfortable for the animals and the children. I go meet you for Sier.
15 Esau say, "Alright, but at least allow me make I assign some of my men to gaurd and protect you. Jacob come respond, "That one no dey neccessary. My lord, e don do me as you don recieve me warmly."
16 Naso Esau come turn around and he begin dey go Sier that same day.
17 But, Jacob come travel go Sucoth. Na there he go build house for himself and he build where him animals go dey stay. Na why dem name the place Sucoth, wey mean shelter.
18 As Jacob dey arrive from Mesopotamia, he come arrive safely at the city of Shechem for the land of Canaan, and he set up him camp for a field wey dey near the city.
19 He buy that part of the field from the descendant of Hamor father of Shechem for one hundred silver.
20 He come biuld altar for there, and he name am after El the God of Israel.