Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Genesis 25

1 Abraham come marry another wife and her name na Keturah.

2 Na she born Zimran, Jokshan, Medan, Midian, Ishbak, and Shuah.

3 Jokshan na the father of Sheba and Dedan. Dedan descendants na the Asshurites, Letushites, and Leummites.

4 Midian son na Ephah, Epher, Hanoch, Abida, and Eldaah. All of dem na descendants of Abraham through Keturah.

5 Abraham give everything wey belong to him to him son Isaac.

6 But before he die, he share gift with all the son of him concubines, and he send them away from Isaac to a land wey dey east.

7-

8 Abraham live for 175 years and he die for old age when he don live a long and good life.

9 Him son Isaac and Ishmael bury him for Machpelah cave, for the field wey dey east of Mamre wey belong to Ephron, son of Zoar the Hittite.

10 Na the field wey Abraham don buy from the Hittite; and na inside there dem bury Abraham and him wife Sarah.

11 After Abraham don die, God come bless him son Isaac, who dey live near the well of the Living one wey see me.

12 Na the account of family of Ishmael, wey Hagar the Egyptian slave of Sarah born for Abraham be this.

13 Na this be the list by their name and tribe, according to the order of when dem born them: Nebaioth, Kedar, Adbeel, Mibsam,

14 Mishma, Dumah, Massa,

15 Hadad, Tema, Jetur, Naphish, and Kedemah. 16Na them be the ancestors of

12 tribes and dem give their name to their villages and camping places.

17 Ishmael na 127 years old when he die.

18 Descendant of Ishmael come live for territory wey dey between Havilah and Shur, to east of Egypt on the way to Assyria. Dem dey live for different place from other descendants of Abraham.

19 Na the story of Abraham son, Isaac be these.

20 Isaac na 40 years old when he marry Rebecca, the daughter of Bethuel and sister of Laban.

21 Because Rebecca no get pikin, Isaac come pray to God for her. God come answer him prayer and Rebecca get belle.

22 She born twins and before dem born them, dem dey fight each other inside their mama womb. She come say, "Why this kind thing dey happen to me?" Na so she go ask God for answer.

23 God come tell her say, "Na two nation dey inside you; you go born two rival people, one go strong pass the other; the older one go serve the younger.

24 The time wey she go born come reach, and she born two sons.

25 The first one be like red and he get plenty hair for him skin, naso dem name him Esau.

26 When dem born the second one, he dey hold the heel of Esau tight, so dem name him Jacob. Isaac na 60 years old when dem born them.

27 Dem come grow up. Esau become hunter wey get skill and he like to dey go outside, but Jacob na the quiet type, him prefer to dey stay at home.

28 Isaac love Esau, because him dey like to eat bush meat wey Esau dey bring home, but Rebecca love Jacob.

29 One day, Jacob dey cook soup and when Esau come back from farm, he dey very tire and hungry.

30 Esau come tell Jacob say, "I dey hungry, give me some of your soup to eat" Na how Esau get him other name "Edom" wey mean red be this.

31 Jacob come reply say, "Ok, but you go give me your position as first born".

32 Esau come say, "See I dey very hungry, wetin dey good to me about my birthright now?"

33 Jacob come say, "you must swear say your birthright na my own" Naso Esau write oath say, him don sell him right as first born to him brother.

34 Jacob come give Esau some bread and stew. Esau eat the food, he stand up and he leave. Na everything wey Esau care about him right as first born be this.

Open Bible reader