Nigerian Pidgin Bible
Genesis 2
1 Naso God complete to dey create heaven and earth and everything wey dey inside am.
2 On the seventh day when God finish to dey create.
3 Him come rest, and God come bless the seventh day and He call am holy because na the day wey Him dey rest from all the work wey him don do.
4 Na this be the things wey happen when God dey create heaven and earth.
5 When God create heaven and earth, no plant or seed dey grow on top earth because God never send rain wey go water earth and nobody dey wey go dey farm on top land.
6 Water come comot from inside ground to dey water the land.
7 God come create man from dust, He come breath the breadthe of life for man nose and man start to dey live.
8 God come create garden of Eden for east and na there he put man.
9 God come make different kind fruit grow for ground. Tree wey dey fine and tree wey get sweet fruits, and for middle of the garden, He put tree of life and tree wey get knowledge of good and evil.
10 One river con dey flow from Eden, e dey water the garden and e come divide into four.
11 Pishon na d first river wey dey flow for the land of Avila where people dey find gold.
12 And the gold wey dey that land dey very pure. Perfume and precious stones also dey that land.
13 Dion na the second river wey dey flow for the land of Kush.
14 Tigrish na the third river wey dey flow east of Ashor land, the fourth river na Euphrate.
15 God come say make man dey in charge of Eden garden.
16 But God come warn am say you fit eat every fruit wey dey inside this garden
17 except the tree wey get knowledge of good and evil, if you eat the fruit, you go die.
18 God come say e no dey good for man to dey alone, I go make helper for him.
19 Naso God create all animal, bring them to man make he see wetin him he fit call them. And man come begin to dey give them name one after the other.
20 He give name to all animal wey dey for there, birds wey dey fly for sky and animal wey dey inside bush, but him still never get helper.
21 Naso God come make man sleep, as he dey sleep, God come take out of him rib.
22 He create woman from him rib and He bring her come meet am.
23 At last the man shout, this na the bone of my bone and flesh of my flesh, I go call am woman because na from me God create her.
24 This one go explain why man go leave him papa and mama to join him wife and the two of them go become one.
25 Now the man and him wife don dey naked and dem no dey shame.