Nigerian Pidgin Bible
Genesis 14
1 Four kings, Amraphel of Babylonia, Arioch of Ellasah, Chedorlaomer of Elam and Tidah of Goiim,
2 start war with other five kings: Bera of Sodom, Birsha of Gomorrah, Shinab of Admar, Shemebar of Zeboiim and king of Bela.
3 The five kings come form alliance and dem gather together for valley of Siddim, wey be dead sea now.
4 Dem don dey under control of Chedorlaomer for twelve years, but when e reach the thirteenth year, dem rebel against him.
5 For fourteenth year, Chedorlaomer come with other kings wey dey under him and dem come with army and dem defeat Rephaim for Ashteroth Karnaim, and Zuzim for Ham, and Emim for Kiriathaim,
6 and Horites for mountain of Edom, and dem pursue them reach Elparan for edge of desert.
7 Dem come turn back to Emishphat, wey dem dey call Kadesh now. And them defeat all territory of Amalekites and Amorites wey dey live for Hazazon Tamar.
8 King of Sodom, Gomorrah, Admah, Zeboiim and Bela come prepare for battle for valley of dead sea.
9 Dem fight king Chedorlaomer of Elam, Tidal of Goiim, Amraphel of Babylonia, and Arioch of Ellasar - four kings against five.
10 As e happen, valley dey full with tar pits. As many of Sodom and Gomorrah army dey run, some dey fall inside pit, the rest con escape inside mountain.
11 The four kings come take everything for Sodom and Gomorah, with food and dem leave.
12 Dem capture Lot and take everything wey he get.
13 But one of Lot servant escape and go tell Abram who dey live near oak grove wey belong to Mamre, the Amorite. Mamre and him family Eshcol and Aner, na them be Abram allies.
14 When Abram hear say them don capture him nephew, Lot, he gather 318 fighting men wey dem born inside him camp. He come pursue Chedorlaomer army reach Dan.
15 Na there he divide him army and attack for night and he defeat them. He chase them reach Hobah for north of Damascus.
16 He collect back everything dey don take and he bring him nephew Lot back with all him property, and all women and other prisoners.
17 After Abram come back from fight with all him people, the king of Sodom come meet him for valley of Shaveh wey be king valley.
18 Melchizedek, king of Salem and priest of God Most High come bring bread and wine to Abram.
19 Melchizedek come begin dey bless Abram say, "God Most High wey create heaven and earth go bless Abram.
20 And blessed na God Most High wey defeat your enemies for you. Abram come give Melchizedek tenth of all goods wey he don recover.
21 King of Sodom come tell Abram say, "give me my people wey dem capture, but you fit keep all the goods wey you don recover."
22 Abram come reply to the king say, "I swear to the Lord God Most High, wey create heaven and earth,
23 say I no go take anything from everything wey belong to you, so that you no go say, "na me make Abram rich."
24 I go only accept wetin my young warriors don eat, and I request make you share goods with my allies, Aner, Eshcol, and Mamre.