Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ezekiel 45

1 When dem divide the land for each tribe make dem share, make dem dedicate one part for God. Make e be 12.5kilometer long by 10 kilometre wide. All the area go be holy.

2 Make square plot of land for Temple dey for this area, wey go be 250meter long for each side and all the surrounding go be 25 meter wide.

3 Make dem measure off half of this area, section 12.5 kilometre by five kilometre, e go contain the Temple, the place wey holy pass.

4 E go be holy part of the country, set apart for priest wey dey serve God for him temple. E go contain their houses and section of land for Temple.

5 Make una set aside the other half of the land as possession of for Levite, wey do the work for Temple. Town go dey there where dem go live.

6 Another section of 12.5 kilometer long and 2.5kilometer wide go dey next to the holy area. Make una set am aside as city where any of people of Israel fit stay.

7 Make una also set aside land for the ruling prince. From western boundary of holy area e go extend to west go Mediterranean Sea; and from all eastern boundary e go extend go eastern border for the country, so that hin length go be same as length of the one of the area wey dem give tribe of Israel.

8 This area go be share wey the ruling prince go get in the land of Israel, so that he no go oppress people again, but I go let rest of the country belong to tribe of Israel.

9 Almighty God talk say, "Una don sin too long, you rulers of Israel! Make una stop to dey oppress and destruct people. Make una dey do right and just. Make una no drive my people commot for their land again. I, the Almighty God, dey tell you this.

10 "Make everybody dey use honest weights and measure:

11 "Make ephah for dry measure dey equal to bath for liquid measure. The standard na homer. Na the resulting measure be this: one homer go dey equal to ten ephahs; and ten ephahs go dey equal to ten baths

12 "Make una weight dey be like this: twenty gerahs go dey equal to one shekel and six shekels go dey equal to one mina

13 "This na the basis on which una go dey pay offering: wheat: one sixtieth of una harvest, Barley: one sixtieth of una harvest.

14 Olive oil: 100th of yield of una trees{make una use bath measure am, bath: ten baths go dey equal to one homer and one homer go dey equal to one kor}

15 Sheep: one sheep out of every 200 from meadow of Israel "Una go bring grain offering, animal wey una go use burn all, and animal for fellowship offering, so that I go give una for una sin. I, the Almighty God, command am.

16 "All people of the land must carry this offering go meet the ruling prince of Israel.

17 Na him duty e go be to provide animal wey dem go use burn all, the grain offering and wine offering for all nation of Israel at new moon festival. He go provide sin offering, the grain offering, offering wey dem go use urn all, and fellowship offering, to take sin of people of Israel away."

18 Almighty God talk say, "On the first day of the first month make una sacrifice bull wey no get problem and make una make the Temple pure.

19 The priest go carry some of the sin offering and put and for doorpost of the temple, for the four corners of the alter, and on post of gate way wey go the inner courtyard.

20 Una go the same thing on behave of everyone wey no know when dem dey sin or through their ignorance on the seventh day of the month. By this way una go keep the Temple holy.

21 "Una go begin the celebration of the Passover festival on the fourteenth day of the first month. For seven days, every go chop bread wey dem no use yeast for.

22 The ruling prince must offer bull as sacrifice for him sin and for all the people, on the first day of the festival.

23 On each of the seven day of the festival make he dey sacrifice to God seven bull and seven rams wey no get problem and burn all of them. Make he sacrifice goat each day for sin offering.

24 For each bull and ram wey he dey sacrifice, me he also offer 17.5 litres of corn and three litre of olive oil.

25 "For festival of shelter, wey begin on fifteenth day of the seventh month, the prince go offer on each of the seven day the same sacrifice for sin, the same wey dem use burn all, and same offering of corn and olive oil."

Open Bible reader