Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 31
1 God speak to me, on the first day of the third month of the eleventh year wey we dey foreign country.
2 He talk say, "Son of man", "Tell king of Egypt and all him people: how powerful you be! Wetin I fit compare you with?
3 You be like cedar for Lebanon, with beautiful, shady braches, tree wey tall and dey touch cloud.
4 Water dey to make am grow, and underground river to feed am. Dem water the place where the tree dey grow and send stream to all trees wey dey the forest.
5 Because dem water am well, e grow pass other trees. Its branch grow thick and long.
6 Every kind bird build nest for its branches; wild animal dey born their young for its shelter; nations of the world rest for its shade.
7 How beautiful the tree be - so tall, with long branch. Its root reach down go deep-flowing stream.
8 No cedar for garden of God fit compare with am. No fir tree don ever get that kind branches, and plane trees no get this kind branches. No tree for God garden dey beautiful like this tree.
9 I give am many branches and make am beautiful. And all the trees for Eden, Garden of God, dey jealous!"
10 "Now then, I, the Almighty God, go tell una wetin go happen to that tree wey grow until e reach cloud. As e gow tall naso e grow proud;
11 So I don reject am and I go allow foreign ruler get am. He go give that tree wetin e deserve for its wickedness.
12 Ruthless foreigners go cut am down and go leave am. Its branches and broken boughs go fall on top every mountain and valley for the country. All nations wey don dey live under its shake go go away.
13 bird go come and live on top the fallen tree, and wild animal go walk on top its branches.
14 And so from now on, no tree, even though dem water well, go green tall like that one or push its top go the cloud""""... and reach that kind height. All of dem don enter trouble to die like man, trouble like those wey go down the world of the dead."
15 Na wetin Almighty God, talk be this: "On the day wey the go world of the dead, I go make underground water cover am as sign of mourning. I go hold back the river and I no go and no go allow many streams flow commot. Because the tree don die, I go bring darkness over Lebanon mountain and I go make all tree of forest wither.
16 When I send am go down world of the dead, the noise of its downfall go shake the nations. All the trees for Eden and all the choice, well- watered tree of Lebanon wey don go world below go happy with the downfall.
17 Dem go come go with am go world of the dead to join those wey don fall already. And all those wey dey stay under its shadow go scatter among nations.
18 "The tree na king of Egypt and all him people. Not even tree for Eden tall and impressive. But now, like tree of Eden, e go go down go world of the dead and join the ungodly and those wey die for battle. Almighty God, talk say, I don talk."