Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ezekiel 30

1 God speak to me.

2 He talk say, "Son of man", "Prophesy and announce wetin I, the Almighty God, dey say. Make you shout these words: Terror day dey come!

3 The day don near, the day when God go act, day of cloud and trouble for all nation.

4 There go be war for Egypt and great distress for Ethiopia, many go die for Egypt; the country go be rob and destroy.

5 "That war go also kill soldier wey dem hire from Ethiopia, Lydia, Libya, Arabia, Kub, and even from among my people."

6 God talk say, "From Migdol for north go Aswan for south, all Egypt defender go die for battle. Egypt proud army go be destroy. I , the Almighty God, don speak.

7 The land go be most empty In the world, and it city go be destroy totally.

8 When I set fire for Egypt and all her defender die, then them go know say I be God.

9 "When that day come and Egypt don destroy, I go send messenger in ship go wake unsuspecting people for Ethiopia, and dem go fear. That day dey come!"

10 The Almighty God talk say, "I go use king Nebuchadnezzar of Babylonia take put end to Egypt wealth.

11 Him and his ruthless army go come destroy the land. Dem go attack Egypt with sword, and dead body go full the land.

12 I go dry up the Nile and I go put Egypt under power of evil people. Foreigners go destroy the whole country. I, God, don speak."

13 The Almighty God talk say, "I go destroy the idol and false god in Memphis. Nobody go dey to rule Egypt, and I go trouble all the people.

14 I go empty southern Egypt and I go set city of Zoan for north on fire. I go punish the capital city of Thebes.

15 I go allow the city of Pelusium, Egypt strong tower, feel my anger. I go destroy wealth of Thebes.

16 I go set fire for Egypt , and Pelusium go be in agony. The wall of Thebes go be broken down, and the city go be flooded.

17 Young men in cities of Heliopolis and Bubastis go die for war, and the other people go be taken as prisoners.

18 Darkness go fall on top Tahpanhes when I break power of Egypt and end the strength wey dem dey proud of. Cloud go cover Egypt, and all people for city go be taken prisoner.

19 When I punish Egypt this way, dem go know say I be God."

20 God speak to me, on the seventh day of the first month of eleventh year wey we dey fore country.

21 He talk say, "Son of man", "I don break arm of king of Egypt. No one don bandage am or put am for sling so that it fit heal and strong enough so that e go fit hold sword again.

22 Now then, na wetin I, the Almighty God, talk: I be enemy of king of Egypt. I go break both his arm-the good one and the one wey don break already- and the sword go fall for hand.

23 I go scatter the Egyptian throughout the world.

24 then I go make arm of king of Babylonia strong and put sword for his hand. But I go break arm of king of Egypt, and in front of his enemy he go cry and die.

25 Yes, I weak am and strength king of Babylonia. When I give am my sword and he point am towards Egypt, everyone go know say I be God.

26 I go scatter Egyptian throughout the world. Then dem go know say I be God."

Open Bible reader