Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ezekiel 29

1 God speak to me, on the twelfth day of the tenth month of the tenth year when we dey foreign country.

2 He talk say, "Son of man", speak against king of Egypt. Tell am how him and all land of Egypt go be punished.

3 Tell am say na wetin Almighty God, dey tell king of Egypt be that: I be una enemy, Una monster crocodile, wey dey lying for river. Una talk say Nile be una own say na una make am.

4 I go put hook through una jaw and make fish for una river stick fast to una. then I go pull una commot for Nile, with all the fish wey dey sick to una.

5 I go throw una and all those fishes for desert. Una body go fall for ground and no one go bury una. I go carry am give bird and animal for food.

6 Then all people of Egypt go know say I be God." God talk say, "The Israelite rely on una people of Egypt for support, but una no better pass weak stick.

7 When dem learn on una, una go break, pierce their ampit and make dem twist their back.

8 Now then, I, the Almighty God, dey tell una say I go get troops to use sword attack una, and dem go una people and animal.

9 Egypt go become empty waste. Then una go know say I be God. "Because una talk say Nile na una own and say na una make am,

10 I be una enemy and enemy of una Nile. I go all Egypt empty waste, from city of Migdol for north go city of Aswan for south, even go border of Ethiopia.

11 No animal or human go waka through am. Nothing go live for there for forty years.

12 I go make Egypt most empty nation for the world. The city of Egypt go destroy for forty years, e go destroy pass other city. I go make Egyptians to dey live for foreign country. Dem go flew go every country and go dey live among other people."

13 Almighty God talk say, after forty years I go bring back people of Egypt from the land wey I don scatter dem,

14 and I go allow dem to dey live for southern Egypt, wey be their original home. Dem go be weak kingdom for there,

15 The kingdom wey weak pass other, and dem no go rule over other nation again. I go make dem no get important that dem no go fit bend other nation do their will.

16 Israel no go depend on them for help again. Egypt fate go remind Israel say e wrong to dey depend on them. Then Israel go know say I be Almighty God."

17 God speak to me, on the first day of first month of 27th year when we dey foreign country.

18 He talk say, "son of man", king Nebuchadnezzar of Babylonia make his army fight against Tyre. Dem shave every soldier head. Dem rub every shoulder bare from carrying heavy load. Nebuchadnezzar and him army work hard so dem fit defeat Tyre, but dem no get anything from their hard work."

19 So this na wetin lord God say: "I go carry Egypt give king Nebuchadnezzar of Babylonia and he go carry the people away. He go carry plenty valuable things for Egypt take pay him army.

20 I go carry Egypt give Nebuchadnezzar as reward for hard work wey he don do for me." Na wetin the Lord God talk be this!

21 "On that day I go make family of Israel strong. So Ezekiel, I go make you speak to them. So dem go know say I be God."

Open Bible reader