Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 21
1 God speak to me.
2 He talk say, "Mortal man", speak against Jerusalem. Speak again the place where people dey worship. and warn land of Israel.
3 say I, God, dey say: I be una enemy. I go draw my sword and I go kill of una, even the good and the evil same way.
4 I go use my sword against anyone from south go north.
5 Everyone go know say I, God , don draw my sword and I no go put am away.
6 "Mortal man, cry like say your heart don break without hope. Cry in sorrow where everyone fit watch you.
7 when dem ask you why you dey cry, tell them say na because of the news wey dey come. When e come fear go full their heart, their hand go weak, their courage go fail, and their knees go shake. The time don come, e don dey here." The Almighty God don speak.
8 God tell me say,
9 "Mortal man, prophesy. Tell people wetin I, God, dey say: A sword, a sword dey polish and sharpened.
10 The sword dey sharpen to dey kill, polish to dey flash like lightning. There no go be rejoicing, because my people no respect my warning and punishment.
11 I don punish the sword, so that I go fit use am. E don dey polish and sharpen so I go fit put am for hand of killer.
12 "Son of man, shout and scream because this sword go be use against my people and all rulers for Israel. Dem want war- so them go be with my people when the sword go come. So clap you leg to show say uno happy.
13 I dey test my people, and if dem no repent, all these things go happen to them.
14 "Now Mortal man, prophesy. Clap your hand, and the sword go strike again and again. Na sword wey dey kill, sword wey dey cause fear and dey slaughter.
15 e dey make my people to dey lose courage and fall. I dey use sword wey dey flash like lightening threat their city and e don ready to kill them.
16 Cut your sharp sword go left and right! Cut am go anywhere wey you turn.
17 Me too go clap my hand and my anger go stop. I, God, don speak."
18 God speak to me.
19 He talk say, "Mortal man", "Mark out two road so king of Babylonia fit bring his sword. Make both of them start from same country. And put signpost for where the roads turn two.
20 one arm go show the king way to the Amorite wey be city of Rabbah and the other na way go Judah, go protected city, Jerusalem.
21 The king of Babylonia come stand for the signpost where the road separate. To know which way he go come go, he dey shake his arrow, dey ask his idol; he check liver of the animal wey he sacrifice.
22 Now! His hand hold arrow wey dem mark "Jerusalem"! e tell am say make he go and set up battering ram, to dey shout battle cry, to carry battering ram go the gate, to throw up earthwork, and dig hole.
23 People of Jerusalem no go believe this, because of agreement wey dey don make. But this prediction na to remind them of their sin and to warn them say dem go capture them.
24 This na wetin I, the Almighty God, dey say: una sin don show. Everyone don sabi how sinful una be. Una dey show una sin for every action. I don condemn una and I go carry una put for una enemy.
25 "You wicked, unholy ruler for Israel, your day, the day of your final punishment don come.
26 I, the Almighty God don speak. Carry your crown and turban commot. nothing go remain the same again. Raise the poor go power! And bring down those wey dey rule!
27 I go destroy that city completely! But this no go happen until the right man become new king. Then I go allow am get this city."
28 "Mortal man, prophesy. Announce wetin I, the Almighty God dey tell the Amorite, wey dey insult Israel. Tell dem say: "sword don ready to destroy; e dey polish to kill, to flash like lightning.
29 Na false vision una see, and the prediction wey una make na lie. Una wicked and evil, and una day dey come, the day of una final punishment. The sword go fall for una neck.
30 "Put the sword for up! I go judge una for the land wey dem create una, for the land wey dem born una.
31 I go pour out my anger against una, my anger go burn una like hot wind, I go carry una put for terrible men hand. Those people wey sabi kill people.
32 Una go like fuel for fire. Una blood go flow deep go the earth-people no go remember una again. I, God, don speak.""