Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 19
1 God tell me make I sing this song of sorrow for two princess of Israel:
2 "Una mother be like female lion, dey lying there with male lion, she go lie down with young male lion and get plenty babies.
3 She dey rear lion and dey teach him to dey hunt; and he learn how to dey eat people.
4 Nation hear about am and carry am put for pit. With hoot dem drag am go Egypt.
5 She wait until she say all hope on go. Then she con dey rear another of her lion and train am to be lion.
6 He dey hunt with the adult lion and come become strong young lion. He learn how to dey catch his food and dey kill and chop man.
7 He attack palace and dey destroy city. Everyone for the country dey fear when dem hear am dey shout.
8 Nation gather to fight am; and people come from everywhere. Dem spread their hunting net and catch am for their trap.
9 Dem put am for cage and carry am go meet kong of Babylonia. Dem carry guard to dey watch am so thet dem no go hear her shout again on top hill of Israel.
10 Your mother be like grapevine, planted beside stream, because say plenty water dey, fruit and leaves come cover the vine.
11 Its branch dey strong ad grow to be royal ornament staff. The vine grow tall wey be say e wan reach cloud and everyone see how e get leaf and how tall e be.
12 But angry hand pull am up from root and throw am for ground. East wind dry its fruit commot. And its branches break commot, dem dry and dem burn dem.
13 Now they don plant am for desert, dry and waterless land.
14 the stem of the vine don catch fire, and fire don burn its branches and fruit. The branches no go strong again, and no go be royal ornament staff again. This na song of sorrow, they don sing am again and again.