Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 15
1 God speak to me later say.
2 Ezekiel, son of man, wetin go happen to wood of grapevine after dey don take the grape? E no be like other tree for forest,
3 because dem no fit use wood of grapevine make anything, even dem no fit use am do small peg take hang something.
4 Na only firewood dem fit use am for. But after the end don burn and its middle don burn, dem no fit use am for anything.
5 The wood useless before fire catch am, and after fire don catch am, e don dey completely useless.
6 I, the Almighty God, promise say as wood of grapevine dey burn as firewood,
7 I go punish people of Jerusalem with fire, some of dem don escape one destruction, but dem go be completely burn. And when that happen, you, Ezekiel, go know say I be God.
8 I go make their country empty wasteland, because dem never dey loyal to me. I, Almighty God don speak.