Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Exodus 39

1 With blue, purple, and red wool, dem make the magnificent garments wey the priests go dey wear when dem wan serve for Holy Place. Dem make priestly garment for Aaron, as God don command Moses,

2 Dem make the ephod with fine linen; blue, purple, and red wool; and gold thread.

3 Dem hammer sheet of gold out and cut am to thin strips wey dem work to fine linen and into blue, purple, and red wool.

4 Dem make shoulder straps for the ephod and attach am to the side, so that e go tight.

5 Dem attach the belt wey dem weave, wey be same materials to the ephod, so that e go form one piece with am as God don command Moses.

6 Dem prepare the carnelians and mount am for gold settings; dem engrave names of twelve sons of Jacob on am with skill.

7 Dem put them for the shoulder straps of the ephod make e represent the twelve tribes of Israel, just as God don command Moses.

8 Dem make the breastpiece with same material and decoration wey dem use make the ephod.

9 Na square and dem fold am to two, 22 centimeters long and 22 centimeters wide.

10 Dem put four rows of precious stones on am: for the first row, dem put ruby, topaz, and garnet;

11 for second row, emerald, sapphire, and diamond;

12 for third row, turquoise, agate, and amethyst;

13 and for fourth row, beryl, carnelian, and jasper. Na for gold settings dem mount them.

14 Dem don engrave names of the twelve sons of Jacob on each of the stone, so that e go represent twelve tribes of Israel.

15 Dem make chains of pure gold wey dem twist like cords for the breastpiece.

16 Dem make two gold settings and two gold rings, and dem attach the two gold rings to upper corner of the breastpiece.

17 Dem tighten the two gold cords to the two rings

18 and dem tighten the other two ends of the cords to the two settings, and dem attach them for front to the shoulder strap of the ephod.

19 Dem make two rings with gold and attach am to the lower corner of the breastpiece, for the inside edge wey dey next to ephod.

20 Dem make two more gold rings and attach am to lower part of front of the two shoulder straps of the ephod, near the seam and above the belt wey dem weave.

21 Just as God don command Moses, dem tie the rings of the breastpiece to rings of the ephod with blue cord, so that the breastpiece go rest above the belt and make e no loose.

22 Dem make the robe wey go under the ephod with complete blue wool.

23 Dem weave binding for the hole wey dey for head so that e no go allow am tear.

24-

26 Round the lower hem, dem put pomegranates of fine linen, and of blue, purple, and red wool, e alternate with bell of pure gold, just as God don command Moses.

27 Dem make shirts of Aaron and him sons,

28 and the turban, caps, linen shorts,

29 and sash of fine linen and of blue, purple, and red wool, and dem decorate them as God don command Moses.

30 Dem make the ornament, the holy sign of dedication, with pure gold, and dem engrave "Dedicated to God" on am.

31 Dem tie am to front of the turban with blue cord, just as God don command Moses.

32 All the work on the Tabernacle don complete finally. The Israelites make everything just as God don command Moses.

33 Dem bring Moses to the Tent and all equipment, hooks, frames, crossbars, posts, and bases;

34 the cover from ram skin wey dem dye red; the fine leather cover; the curtain;

35 the Covenant Box wey stone tablets dey, the pole, and the cover;

36 the table and accessories, and the bread wey dem offer to God;

37 the pure gold lampstand, the lamps, all the accessories, and oil wey dem go dey use for the lamp;

38 the gold altar; the anointing oil; the sweet-smelling incense; the curtain for entrance of the Tent;

39 the bronze altar and the bronze grating, the poles, and all accessories; the washbasin and the stand;

40 the curtain for the enclosure and the posts and bases; the curtain for enclosure entrance and the ropes; the pegs for the Tent; all equipment wey dem go use in the Tent;

41 and the magnificent garments wey the priests go wear for Holy Place " the holy clothes for Aaron the priest and him sons.

42 The Israelites don do the work just as God don command Moses.

43 Moses check am and see say dem don make everything just as God don command. Naso Moses bless them.

Open Bible reader