Nigerian Pidgin Bible
Exodus 15
1 Moses and Israelites come sing this song to God: "I go sing to God because he don win glorious victory; he don throw horses and their riders inside sea.
2 God na my strong defender; na him be the one wey don save me. He be my God, and I go praise him, my father God, and I go sing about him greatness.
3 God na my warrior, Na God be him name.
4 "He throw Egypt army and chariots inside sea; the best Egypt officer die inside Red Sea.
5 The deep sea cover them; dem sink go down like stone.
6 "God, your right-hand dey glorious in power; e break enemies to pieces.
7 You overthrow those wey dey rise against you in majestic greatness; your anger blaze out and burn them up like straw.
8 The blast of your breath dey make water pile up high; e stand up straight like wall; the deepest part water come become solid.
9 The enemy say, "I go pursue and catch them; I go divide their wealth and take all I want; I go draw my sword and everything wey dem get;
10 But one breath of God, and the Egyptians perish inside water; dem sink like lead for terrible water.
11 "God, who among the gods be like you? Who be like you, wonderful in holiness? Who fit perform miracles and mighty acts like your own?
12 You stretch your right hand out, and earth swallow our enemies.
13 You dey faithful to your promise, and you lead the people wey you don rescue; you dey guide them by your strength to your holy land.
14 Nations don hear, and dey tremble with fear; terror don grip the Philistines.
15 The leaders of Edom dey fear; Mighty men of Moab dey tremble; people of Canaan dey loose their courage.
16 Terror fall on them. Dem see your strength, O LORD, and dem stand helpless with fear until your people don waka past " the people wey you set free from slavery.
17 You bring them in and plant them on top mountain, the place wey you, God, don choose for your home, the Temple wey you don build yourself.
18 God, na you go be king for life."
19 The Israelites waka through the sea on top dry ground. But when Egyptian chariots with their horses and drivers enter the sea, God bring the water back, and e cover them.
20 Prophet Miriam, who be Aaron sister take her tambourine, and other women join to play tambourine and dance.
21 Miriam come sing for them: "Sing to God, because he don win glorious victory; he don throw horses and their riders inside sea."
22 Moses come lead the people commot from Red Sea into desert of Shur. Dem waka through the desert for three days, but dem no find water.
23 Dem come reach a place wey dem dey call Marah, but water wey dey there bitter, dem no fit drink am. Na why dem name am Marah.
24 The people complain to Moses and ask, "Wetin we go drink?"
25 Moses come pray to God, and God show him a piece of wood, wey he throw inside the water; the water come become good and dem fit drink am. Na there God give them laws to dey obey, and he test them.
26 He say, "If una go obey me completely by doing wetin I consider right and you go keep my command, I no go punish una with any of the diseases wey I bring on Egyptians. I be God, the one wey heal una."
27 Dem come reach Elim, the place wey get twelve springs and seventy palm trees; dem come camp for there by the water.