Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Exodus 11

1 God come tell Moses say, "Na only one more punishment I go send on king of Egypt and him people. After that, he go allow you leave. In fact, na him go chase all of una out of here.

2 Now tell people of Israel say make dem ask their neighbors for gold and silver jewelry."

3 God don make Egyptians respect Israelites. The officials and all people believe say Moses na great man. 4Moses tell the king say, "God say, "Around midnight I go pass through Egypt,

5 and every firstborn son for Egypt go die, from king son, who be heir to throne, take reach slave woman son wey dey grind corn. Firstborn of all cattle go die too.

6 Loud cry wey never happen before, and wey no go ever happen again go happen all over Egypt.

7 But, even dog no go bark Israelites or their animal. Then you go know say I, the LORD, go make difference between Egyptians and Israelites.""

8 Moses come conclude and he say, "All your officials go come to me and bow down before me, and dem go beg me say make I take all my people and go away. I go come leave." Naso Moses vex and leave king.

9 God don tell Moses say, "The king go continue to dey refuse to hear you, so that I go fit do more miracle for Egypt."

10 Moses and Aaron don perform all the miracles before king, but God don make him stubborn, and he no allow Israelites leave him country.

Open Bible reader