Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Exodus 1

1 Na the name of Jacob son wey follow him go Egypt with their own family be this:

2 Reuben, Simeon, Levi, Judah.

3 Issachar, Zebulun, Benjamin.

4 Dan, Naphtali, Gad, and Ashar.

5 Jacob get seventy direct descendants for Egypt. Him son, Joseph don dey Egypt before.

6 As time dey go, Joseph, him brothers and others wey dey that same generation die.

7 But, their descendant, the Israelites, born plenty pikin and dem dey very powerful and dem come multiply full Egypt.

8 A new king wey no know anything about Joseph come enter power.

9 He tell him people, "See, Israelites don plenty pass us and dem dey strong pass us.

10 We suppose make plan make dem no grow more. If war come, dem fit join enemy fight us, and dem go run commot from the country.

11 Na so Egyptians turn Israelites to slaves. Dem put them under wicked slave drivers, so that dem fit make them weak wit hard labor. Dem force them build Pithom cities and Remeses wey be supply center for king.

12 But as the Egyptians dey oppress them, naso dem dey multiply, and naso Egyptians dey fear them.

13 Naso Egyptians dey use Israelites without mercy.

14 Dem make life bitter for them. Dem force them to make bricks and do all kind work wey dey for field.

15 Pharaoh, king of Egypt come command Hebrew midwives, "Shiphral and Puah".

16 "Make una dey watch Hebrew women as una dey help them when dem dey born pikin. If the pikin na boy, kill am; if na girl, no kill am."

17 Because say the midwives get fear of God, dem no obey king command. Dem no kill any boy.

18 Na so the king call midwives. He ask them, "Why una dey allow boys live?"

19 Dem answer say, "Hebrew women no be like Egyptian women;

20 na with ease dem dey born pikin, and their pikin go don come out before we fit reach their side.

21 Because say midwives get fear of God, he dey good to them and he give them their own family. Na so Israelites dey multiply and dey get stronger.

22 Pharaoh come command him people say: "Make una throw every newborn Hebrew boy inside Nile River. But, make una leave girls"

Open Bible reader