Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Esther 1

1 King Xerxes don rule over 127 provinces,

2 From him royal throne for Persia capital city of Susa, all the way from India to Ethiopia

3 For the third year wey he don dey reign he do party for all him officials and administrators. The armies of Persia and Media dey for there, and governors and noblemen of all the province.

4 He dey show off all the riches of the imperial court with all hin glory and majesty for six whole months.

5 After that, the king con do party for all the people for the capital city of Susa, rich and poor for the same way. The party con last for a whole week and na for garden of the royal palace dem do am.

6 Dem decorate the courtyard with blue and white curtains, wey dem use cords of fine purple linen tie to silver rings on top marble pillars. Dem don put couches wey dem use gold and silver make for the courtyard, wey dem cover with white marble, red feldspar, shining mother-of-pearl, and blue turquoise.

7 Dem use gold cup serve the drinks, no two of them dey alike, and the king dey nice with the royal wine.

8 Limit no dey on the drinks; the king don give order to the palace servants say everyone fit have enough wey dem want.

9 Queen Vashti dey do party for the women inside the royal palace.

10 The king dey drink and he dey feel happy on the seventh day of him party, naso he call him seven servants wey be him personal servants, Mehuman, Biztha, Harbona, Bigtha, Abagtha, Zethar, and Carkas.

11 He order them say make dem bring Queen Vashti inside, she dey wear her royal crown. The queen na beautiful woman, and the king wan show off her beauty to the officials and all him guests.

12 But when the servants con tell Queen Vashti the command of the king, she no gree come. Naso the king vex.

13 Na normal thing for king make he ask for expert opinion on questions of law and order. Naso he call him advisor, wey understand the law.

14 Those wey he dey always turn to for advice na Carshena, Shethar, Admatha, Tarshish, Meres, Marsena, and Memucan. Dem be seven officials for Persia and Media wey hold the office wey high pass for the kingdom.

15 He tell these men say, "I, king Xerxes, send my servant to Queen Vashti with command, and she no gree obey am! Wetin the law talk say make we do with her?"

16 Then Memucan declare to the king and him officials say: "Queen Vashti don insult the king and him officials- in fact, she don insult everybody for the empire!

17 Every woman for the empire go begin to dey look down on her husband when dem hear wetin the queen don do. Dem go say, "King Xerxes don command Queen Vashti make she come to him, and she no gree come."

18 When the wives of the royal officials of Persia and Media hear about the behavior of the queen dem go dey tell their husbands about am before the day end. Wives for everywhere no go get respect for their husband, and husbands go dey vex with their wives.

19 If e con please Your Majesty, make you issue a royal command say make Vashti never appear before the king again. Make you order am say make dem write am into the laws of Persia and Media, so that dem no go fit change am. Then make you give her place as queen to a better woman.

20 When all this big empire don know your command, every woman go treat her husband with proper respect, whether he dey rich or he dey poor."

21 The king and the official con like this idea, and the king do wetin Memucan don suggest.

22 He con send a message in the language and the system wey dem dey write for that province to each of the royal provinces, wey talk say make every husband be the master of him home and make he dey talk with final authority.

Open Bible reader