Nigerian Pidgin Bible
Deuteronomy 33
1 Na prophet Moses be, and before he die, he bless tribes of Israel as he say:
2 God come from Mount Sinai. From Edom, he give light to him people, and him glory dey shine from Mount Paran. Thousands of him warriors dey with him, and fire dey for him right hand.
3 God love tribes of Israel, and he dey protect him people. Dem hear him words and worship for him feet.
4 I don call meeting of Israel tribes and give una God Law.
5 Una and una leaders con make God una king.
6 Tribes of Reuben, una go live, even though una tribe go always dey small.
7 God go hear una, tribe of Judah, as una beg make una come home safe. Una fight una enemies alone, now God go help una.
8 For Massah and Meribah Spring, God hear una, tribe of Levi. Una dey faithful, and that na why priesthood belongs to Levi tribe.
9 To protect Israel agreement with God dey important to una pass the life of una papa and mama, or brother and sister, or una own children.
10 Una dey teach Israel God law, and for place of worship una offer sacrifices and burn incense.
11 I pray say God go bless everything una do, and make una strong to destroy una enemies.
12 God Most High love una, tribe of Benjamin. He go live for una hills, and protect una.
13 Descendats of Joseph, God go bless una with precious water from deep wells and with dew from heaven.
14 Month by month, una fruit go ripe for sunshine.
15 Una go get rich harvest from slopes of old hills.
16 God wey appear for burning bush wan give una the best wey the land fit produce, and e go be prince crown for Joseph head.
17 Armies of Ephraim and Manasseh dey strong and majestic like bull or wild ox. Dem go destroy far away nations.
18 Zebulun, Make una dey happy as una boats dey move; Issachar, make una dey happy for una tents.
19 The Sea go make una rich, and una go get treasure from sand wey dey beach. So make una invite other tribes to come celebrate with una and offer sacrifice to God.
20 Tribe of Gad, God go bless una with more land. So make una shout praises! Una tribe be like lion wey destroy the victim.
21 Una leaders meet together and choose the best land for una tribe, but una obey the Lord and help the other tribes.
22 Dan tribe, una be like lion pikin wey snake dey scare away.
23 God dey happy with una, people of Naphtali. He go bless una and give una the land go west and south.
24 God greatest blessing dey for una, Asher tribe. Una go be the one wey God like pass other tribes. Una go dey rich with olive oil
25 and get strong town gates with bronze and iron bolts. Una people go dey powerful as long as dem live.
26 Israel, no other god be like our own " na cloud be him chariots as he dey ride for sky to come help us.
27 The eternal God na our hiding place; he dey carry us for him arms. When God tell una to destroy una enemies, he go make them run.
28 Israel, una go live for safety; una enemies go run commot. The dew go fall from sky, and una go get plenty grain and wine.
29 God don rescue una and give una plenty blessings pass any other nation. He protect una like shield and na him be una majestic sword. Una enemies go bow in fear, and una go waka for their backs.