Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Deuteronomy 3

1 "When we move go north for Bashan region, and King Og come out with all him men to fight us, near town of Edrei.

2 But God tell me say, "No fear him. I go give him, him men, and all him territory to you. Do the same thing wey you don to Sihon the Amorite king wey rule for Heshbon."

3-5

6 Naso the LORD our God help us destroy Og and him army and conquer all him Bashan kingdom, with Argob region. Him kingdom get plenty villages and 60 towns with tall walls and gates wey dem lock with bars. We destroy all of them, and kill everybody,

7 but we keep the animals and other things wey dey useful.

8 Sihon and Og don rule Amorite kingdom for east of Jordan River, from Arnon River take reach Mount Hermon for north, and we take all of am.

9 Na Mount Hermon Sidon people dey call Mount Sirion, and Amorites dey call am Mount Senir.

10 We take all towns for highlands, all of Gilead, and all of Bashan take reach Salecah and Edrei, two of the towns wey Og don rule.

11 King Og na the last of Rephaim and him coffin dey town of Rabbah for Ammon. Na hard black rock dem use make am, and e be four meters long and like two meters wide.

12-16

17 I give some of the land and towns wey we don capture to tribe of Reuben and Gad. Na their share start from Arnon River for south, Aroer town near the River, and dem go far reach north to include half of Gilead region for south. Northern part of their land go far east reach upper Jabbok River, wey form their border with the Ammonites. I give them the eastern side of Jordan River too, from lake Galilee south take reach Dead Sea below Mount Pisgah slope. For half tribe of Manasseh, I give them the northern half of Gilead, and all of Bashan region. Bashan don become King Og own, and na Land of Rephaim dem dey call Argob region for Bashan. Jair, from Manasseh tribe take all of Argob region for Bashan, take reach Geshur and Maacah. The Israelites begin dey call Bashan "Villages of Jair," and na that still be the name. I give Machir clan the northern half of Gilead.

18 -

19 That same time, I tell men of Reuben, Gad, and East Manasseh say: Na the LORD our God tell me make I give una this land with the towns, and na wetin I don do be that. Now, una wives and children fit stay here with una plenty flocks of sheep and goats and una plenty cattle. But all of una men wey fit serve for our army go cross Jordan River and help other tribes, because dem be una relatives.

20 God go allow them defeat the enemy nation for west side of Jordan River and take their land. After that, una fit come back to the land wey I give una.

21-

22 I come tell Joshua say, "You see how the LORD our God help us destroy King Sihon and King Og. So, no fear! Anywhere una go, God go fight for una and help una destroy una enemies."

23 For that same time I pray and beg say,

24 "Our LORD, e be like say you just begin dey show me your great power. No other god for heaven or earth fit do the mighty things wey you do.

25 The land wey dey west of Jordan na very good land. Abeg allow me make I cross the Jordan and see the hills and Lebanon Mountains."

26 But God vex with me because of una, and he no listen to me. He tell me say, "E don do! I no wan hear again.

27 Climb to top of Mount Pisgah and look north, south, east, and west. Look am well, but you no go cross Jordan River.

28 Na Joshua go lead Israel across Jordan to take the land, so help him make he dey strong and brave and tell him wetin he go do.

29 After this, we stay for valley of Beth-Peor.

Open Bible reader