Nigerian Pidgin Bible
Deuteronomy 21
1 Suppose say una find the body of the person for a field in the land wey the LORD una God dey give una, and nobody know who kill the person.
2 The judges and other leaders from towns wey dey around there must find out which town dey close to where dem find the dead body.
3 The leaders from that town go come go to where dem dey keep their cattle and choose a young cow wey dem never use do any work before.
4-
5 Dem and some of the priests go take this cow go valley wey dey near wey get stream, but wey no get crops. When dem reach the valley, make the leaders break the cow neck. The priest must dey there, because the LORD una God don choose them to be him special servants for place of worship. God don choose them to bless the people for him name and make dem be judges for legal cases, whether e involve property or wound.
6 The town leaders go wash their hand on top the body of the dead cow
7 and say, "We no get part for this killing, and we no know who do am.
8-
9 But since na innocent person die, we beg you, our LORD, take this sacrifice and forgive Israel. We be your people, and na you save us. Abeg no put this crime for our head." If una obey God and do these things, he go forgive Israel.
10 From time to time, you men go serve as soldiers and una go fight for battle. The LORD una God go help una defeat una enemies, and una go take plenty prisoners.
11-
13 One of these prisoners fit be beautiful woman, and una fit wan marry her. But una must first bring her come una house, make she shave her head, cut her nails, remove her foreign cloth, and begin dey wear Israelite cloth. She go mourn her father and her mother for one month, then una fit marry her.
14 Later, if una no dey happy with the woman, una fit divorce her, and she fit go free. But una don sleep with her as una wife, so una no fit sell her as slave or make her una own slave.
15-
17 Suppose say a man get two wife and love one pass the other. Na the first son of any of the wife be the man first-born son, even if the boy mama na the wife wey the man no love. Later, when the man don dey near to die and he dey divide him property, na must for him to give double portion to him first-born son, because na him dem born first.
18 A father and mother fit get a stubborn son wey no dey gree obey them, even after dem don punish him.
19 If a son be like that, make him parent drag him go town gate, where town leaders dey do their meeting.
20 Make the parent tell the leaders say, "This our son dey stubborn and he no dey obey. He dey use all him money to dey drink and go party."
21 Make the men of the town stone that son to death, because dem need to chase the evil wey the boy don bring come the community. Everyone for Israel go begin dey fear when dem hear how una don punish am.
22 If una kill a criminal, and una hang the dead body on top a tree,
23 make una no leave am there overnight. Make una bury am that same day, because dead body of criminal wey una hang on top tree go bring God curse on the land. The LORD una God dey give this land to una, so make una no make am unclean by leaving dead body of criminal wey una kill for show.