Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Deuteronomy 1

1 For this book na the words wey Moses tell people of Israel when dem dey desert for east of Jordan River. Dem dey Jordan Valley near Surph, between Paran town for On side and Tophel, Laban, Hazeroth, and Dizahab for other side.

2 (Na eleven days e take to travel from Mount Sinai take reach Kadesh Barnea through way of Edom hill country.)

3 On first day of the eleventh month of the fortieth year after dem don leave Egypt. Moses tell the people everything God don command him to tell them..

4 This na After God don defeat king Sihon of Amorites, wey rule for town of Heshbon, and King Og of Bashan, wey rule town of Ashtaroth and Edrei.

5 When the people dey east of Jordan for territory of Moab, na that time Moses begin dey explain God law and commands. He say,

6 "When we dey Mount Sinai, the LORD our God tell us say, "Una don stay long enough for this mountain.

7 Make una leave this place and go to the land wey belong to the Amorites and their neighbor Canaanites. The lands go be Jordan River Valley, the hill country and lowlands, the Southern Desert, the Mediterranean Seacoast, the Lebanon Mountains, and all territory reach Euphrates River.

8 I give una this land, just as I don promise una ancestor Abraham, Isaac, and Jacob. Now, make una go take the land.

9 Moses tell the people say, "After God command us make we leave Mount Sinai, I tell una: Israel, e too big for one person to be una leader.

10 The LORD our God don bless us, and we don plenty like star for sky.

11 God don even promise to bless us a thousand times more, and I pray say he go do am.

12 But I no fit take care of all una problems and settle una fights alone.

13 Make each tribe choose men wey get experience, wey people know for their wisdom and understanding, and I go make those men the official leaders of their tribes.

14 And una gree say na good idea.

15 Naso I take the wise leaders wey una choose from una tribes, and I put them in charge of una. Some dey in charge of a thousand people, some na a hundred, some na fifty, and others na ten. And I choose other officials all through the tribes.

16 Na that time I tell them say, "Make una dey listen to quarrel wey dey happen among una people. Judge every quarrel fairly, whether e concern only una own people or e concern foreigners wey live among una.

17 Make una no dey partial with una decisions; judge every person same way, no matter who dem be. No dey fear anyone, because na from God una decisions dey come from. If any case dey too difficult for una, bring am to me, and I go decide am.

18 Na for the same time I give una instructions for everything else wey una go dey do.

19 We do wetin the LORD our God don command us. We leave Mount Sinai and go through that fearful desert as we go hill country of the Amorites. When we reach Kadesh Barnea,

20-

21 I tell una say, "We don reach the hill country. Na Amorites get am now, but the LORD our God dey give am to us. He be the same God wey our ancestor worship, and he don tell us make we go take this land, so make una no stop or fear.

22 Then, all of una come meet me and say, "Before we enter the land, make we send some men to go check am. When dem come back, dem fit tell us about the the towns we go find and which road we go follow reach there."

23 E be like good idea, naso I choose twelve men, one from each tribe.

24 Dem check the hill country reach Eshcol Valley

25 and dem even bring fruit come back. Dem say, "The LORD our God dey give us good land."

26 Una no wan enter the land, and una no gree obey the LORD una God.

27 Una stay for una tents and dey complain say, "E be like say God hate us " he bring us out of Egypt, so that he fit allow Amorites capture us and kill us.

28 We dey fear, because the men wey go check the land tell us say the cities dey big, and e get walls wey tall reach sky. The people wey dey live for there tall and strong pass us, and some of them na Anakim giants. We no get anywhere to go.

29 Then, I come say, "Make una no worry!

30 The LORD our God go lead the way. He go fight for our side, just as he do when we see him dey handle the Egyptians.

31 And una know say God don dey take care of us since we dey desert, just as una fit carry one of una children."

32 But una still no trust God,

33 even as he don dey with us for inside desert. For day time, God dey always dey for cloud, and he dey lead for right direction and dey show us where we suppose camp. And for night, he dey there for inside fire.

34 Una don make God vex, and he say:

35 No one for this evil generation go enter the fertile land wey I don promise to give una ancestors.

36 Na only Caleb son of Jephunneh go enter am. He obey me completely, so give and him descendants the land wey land wey he don check.

37 God dey even vex with me because of una, and he say, "Moses, I no go allow you enter the land too.

38 Instead, I go allow Joshua your assistant lead Israel to go take the land. So, make una encourage him."

39 God tell us again say, "People of Israel, una talk say dem go take una children as prisoner in battle for the land. But I go allow them enter the land, and with my help dem go take am and live for there.

40 Now, make una turn back enter desert and follow way of Red Sea road.

41 Una come tell me say, "We don disobey the LORD our God, but now we wan obey him. We go enter the hill country and fight, just as he don tell us." Naso una pick una weapon, una think say e go dey easy to take over the hill country.

42 But God say, "Moses, warm them make dem no go to hill country, I no go help them fight, and their enemy go defeat them."

43 I tell una wetin God don talk, but una no answer me. Una disobey him and still go to hill country. Una think say una get power!

44 But when the Amorites wey dey hill country attack from their towns, una run from them like say una dey run from plenty bees. The Amorites chase una troops enter Seir take reach Hormah, and dem kill them as dem dey go.

45 Naso una come back to the place of worship for Kadesh-Barnea and begin dey cry, but God no hear una prayers.

46 After we don dey Kadesh for some months, we obey God and begin dey go inside desert for the way of Red Sea road.

Open Bible reader