Nigerian Pidgin Bible
Daniel 8
1 I see another vision for third year when Belshazzar be king.
2 For the vision, I just see myself for Susa city wey dem wall for Elam province. As I dey stand for River UIai,
3 I see one ram wey get two horns beside the river, one of dem dey longer and new pass the other one.
4 I see the ram dey run with him horn go west, north, and south. No animal fit stop am or escape him power, he dey do as he like, he con get pride join.
5 As I dey think wetin e mean, one goat dey rush come from west, e dey run so tey him leg no dey reach ground. E get one horn between him eyes.
6 E con meet the ram wey I see before dey stand for the river, and e dey rush go meet am with full force.
7 I watch am dey attack the ram. E dey vex so tey he hit the ram and break hin two horns, the ram no get strength wey he fit take attack am back, so he throw am for ground and match on top am, and nobody fit save am.
8 The goat con get more pride, but him horn break when him power don high, na four big horn grow to replace am and each one dey point to different direction.
9 One out of the four horn grow little horn , wey the power reach south and the east go the promise land.
10 E grow strong so tey e fit attack the army wey dey heaven, even the stars, e throw some of dem for ground waka on top dem.
11 The little horn con strong turn against God, the rulers of heaven army. E stop the daily sacrifice wey dem dey offer give the ruler. And destroy the holy place where people dey worship the ruler.
12 People dey sin for there instead make dem dey offer proper daily sacrifice, the true religion no dey again and the horn dey successful for everything wey e do.
13 Naso I hear one angel dey ask another one say, "Na how long all these thing wey we see for vision go continue? Na how long the terrible sin go replace the daily sacrifice? Na how long dem go dey match on top army wey dey for heaven and Temple?"
14 I hear the angel dey answer say, "E go continue for
2,300 night and day, dem no go offer sacrifice this time and the temple go dey restored."
15 I dey try know wetin the vision mean before suddenly I see say somebody dey stand for my front.
16 I hear one voice dey call from River UIai, "Gabriel explain wetin he see to am."
17 Gabriel con stand beside me, and I dey fear so tey I fall for ground. He tell me say, "Son of man, hear wetin e mean. The vision na all about the end of the world."
18 As he dey talk , I no know when I fall for ground, but he hold me, carry me stand for my feet,
19 and talk say, I dey show you wetin go happen when you vex God. The vision na about end time.
20 "The ram wey you see wey get two horn na kingdom of Medes and Persia.
21 The goat na the kingdom of Greece, and the big horn wey dey between his eyes na the first king.
22 The four horns wey come out when the first one break na the four kingdom wey the nation go dey divided to and wey no go dey strong reach the first kingdom.
23 "There go be one stubborn, deceitful and evil king when the end of those kingdom don near and dem don dey so wicked so tey dem must punish them.
24 He go grow strong- but no be by him own power. He go cause terrible destruction and go dey successful in everything wey he do. He go bring destruction on top powerful men and on top the people of God.
25 Because he dey lie, he go dey successful for him deceitful ways. He go dey proud of himself and e go destroy many people without warning. He go even defy the greatest king, but dem no go even use human power destroy am.
26 This vision about night and day wey I don explain give you go come true. But no tell anyone for now, because e go take long time before e go come true."
27 I dey sad and sick for many days, then I get up go back go do the work wey the king don give me, but the vision shock me and I no fit understand am.